bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Esther 7
Esther 7
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 6
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 8 →
1
So di king and Haman kon go chop with Kween Estha
2
for di sekond time. As dem dey drink wine, di king kon ask Estha, “My kween, na wetin yu wont make I do for yu? Make yu tell mi and I go do am for yu. I go even give yu half of my kingdom.”
3
Estha ansa, “Abeg! My king, if yu go agri with wetin I wont, den make yu nor allow dem kill mi and my pipol.”
4
Bikos dem don sey make dem distroy, both mi and my pipol! If to sey dem just sell us as slaves, I nor for tell yu about am, but dem go soon kill all of us finish.
5
Den King Zazes ask Kween Estha, “Na who won kill una? Where di pesin dey?”
6
Estha ansa, “Na dis Haman bi di pesin wey won kill all of us!” Den Haman kon dey fear as e dey look di king and kween.
7
Di king vex kon stand up go di gardin, den Haman kon go knee down for di kween front dey beg am, bikos e know sey di king go ponish am.
8
As Haman still knee down near Estha dey beg am, di king kon waka enter from di gardin. As di king si am, e kon sey, “So yu even won rape my wife, di kween for my present?” As di king still dey tok, dem kon kover Haman face.
9
Den one of di king savant wey dem dey koll Harbona kon sey, “Na true, Haman even dig one pit for en house where e won hang Mordekai put and na dis Mordekai save my king life. Di pit deep rish seventy-five fit!” Di king kon sey, “Make una go hang Haman put for di pit wey e dig!”
10
So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.
← Chapter 6
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 8 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
Recommended Reading
Commentary
Esther Commentaries
→
Devotional
Esther Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→