bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Judges 17
Judges 17
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 18 →
1
E get one man, e name na Mikaya and e dey stay for Efraim hill kountry.
2
One day, e tell en mama, “Yor 1,000 one hundred silva wey dem tif wey kon make yu curse di tif, dey my hand.” Na mi tif am. Den en mama sey, “Bikos yu gri sey na yu tif am, make God bless yu!”
3
So e give di money back to en mama, den di mama sey, “Bikos I nor wont make di curse follow my pikin, I dey dedikate dis money give God. I go use am take buy wood kon make juju wey dem kover with silva.”
4
So wen di pikin give en mama di money, di woman take two hundred silva kon give pesin wey turn am to juju and dem kon put am for Mikaya house.
5
So, Mikah build shrine for di juju, den e make one priest garment kon wear am for en pikin, so dat e go bi en priest.
6
Dat time, Israel pipol nor get king; so all di pipol dey do wetin dem like.
7
One day, one Levi man wey dey stay Betlehem for Judah kon kom di aria.
8
E komot for Betlehem go look for anoda place where e go stay. Wen e dey travel, e kon rish Mikah house for di hill kountry wey dey Efraim.
9
Mikah ask am, “Na where yu from kom?” Di man ansa, “I bi Levi from Betlehem for Judah and I dey look for where to stay.”
10
So, Mikah tell am, “Yu fit stay here with mi and yu go bi my papa and priest. Evry year, I go dey give yu ten silva, klot and food.”
11
Di Levi man gri and e kon bi priest like Mikah pikin too.
12
So e stay Mikah house and Mikah kon make di man e own pesinal priest.
13
Den Mikah sey, “I know sey God go bless mi naw, bikos I get Levi pesin as my priest.”
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 18 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21