bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Zechariah 3
Zechariah 3
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 4 →
1
For anoda vishon; I si Joshua wey bi di High Priest stand for God angel front; Satan too stand for Joshua rite hand side and e dey akuiz am.
2
So Oga God tell Satan, “Satan! Mi wey bi God rijet all wetin yu tok. Yes! God wey love Jerusalem go kondemn yu. Dis man nor bi like stik wey dem take komot from fire?”
3
Joshua still stand near di angel with di dirty klot wey e wear.
4
Den di angel tell doz wey stand near am, “Make una pul di dirty klot wey dis man wear so, komot from en body.” Den e tell Joshua, “I don forgive yu all yor sins and naw, I go give yu new klot make yu wear.”
5
Den I sey make dem wear klean crown for Joshua head. Dem do as I tok kon wear new klot for am too and God angel stand near us.
6
Den God angel enkourage and tell Joshua,
7
“God wey dey mighty sey, ‘If yu obey my laws kon keep my kommands, na yu go bi oga for my temple and for my kourt and I go add yu join all dis angels wey dey my side naw.’
8
Joshua di High Priest and all di priests, make una listin to mi, na una bi my sign about wetin go happen; bikos I go soon bring my savant, wey bi di Branch!”
9
“Si, I dey put one stone wey get seven eye for Joshua front. I go rite put kon remove all di sin wey dis land don kommit.
10
And for dat day, una go invite una neighbours make dem kom sidan with una under una vine and fig tree, bikos una go get peace.” Dis na wetin Oga God tok.
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 4 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14