bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Joshua 15
Joshua 15
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 16 →
1
Di land wey dem give Judah tribe akordin to dia family, long from Edom borda go rish Zin Wildaness for Negev wey dey sout.
2
Dia borda for sout start from di sout-side for di Salt Sea
3
go rish Akrabbim Ascent sout kon cross go Zin, till e rish Kadesh Barnea sout kon cross from der go Hezron on-top Addar and e kom down for Karka.
4
Di land cross go Azmon, till e rish Egypt wotaside kon end for di sea. Na dis bi di borda for sout.
5
Di borda for east na from di Salt Sea go rish Jordan River. Di borda for nort start from di Salt Sea from Jordan River mout
6
go rish Bet-Hoglah, den cross di nort for Bet-Arabah go di Stone wey bi Reuben pikin, Bohan own.
7
E kom from der go Debir from Akor Valley den turn face nort go rish Gilgal (wey dey opposite Adummim Pass for di sout-side for di valley) kon cross En-Shemesh wota go rish En-Rogel.
8
E from der go Ben-Hinnom Valley go rish di lowland for Jebus for sout (wey bi Jerusalem) and from der, e go on-top di hill opposite Ben-Hinnom Valley for west wey dey di end for Refah Valley for nort.
9
E from der go on-top di hill go rish di spring wota for Neftoah, plus di whole town for Mount Efron, den from Mount Efron to Baalah (wey bi Kiriat-Jearim).
10
E turn from Baalah face west for Mount Seir kon cross di lowland for Mount Jearim go nort (wey bi Kesalon), den land for Bet-Shemesh kon cross go Timnah.
11
E still from der go Ekron lowland for nort till e rish Shikkeron, den cross go Mount Baalah, till e rish Jabneel kon end for di sea.
12
Na Mediterranean Sea bi di borda for west. And na dis bi di borda for Judah tribe and family.
13
Kaleb wey bi Jefunneh son from Judah tribe, dem gi-am Kiriat-Arba (wey bi Hebron), just as God tell Joshua. (Na Arba bi Anak papa.)
14
From der, Kaleb porshu Sheshai, Ahiman and Talmai wey bi Anak shidren
15
kon attack Debir pipol. (Before-before, dem dey koll Debir pipol Kiriat-Sefer.)
16
Kaleb kon sey, “Di pesin wey go win Kiriat-Sefer, I go gi-am my dota Aksah, as en wife.”
17
Wen Otniel, Kenaz pikin wey bi Kaleb broda win am, Kaleb kon give en dota, Aksah to am as wife.
18
One day Otniel kom meet and beg Aksah make e ask en papa for some land. Wen e kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont.”
19
E ansa, “Abeg, make yu give mi one special gift. Since yu don give mi land for Negev aria, make yu give mi spring wota.” So en papa kon gi-am both di spring for up and di one for bottom.
20
Dis na di land wey dem give Judah tribe and dia family:
21
Dis towns dey Judah land end for sout near Edom borda and dem bi: Kabzeel, Eda, Jagur,
22
Kinah, Dimonah, Adadah,
23
Kedesh, Hazor, Itnan,
24
Zif, Telem, Bealot,
25
Hazor-Hadattah, Keriot Hezron (wey bi Hazor),
26
Amam, Shema, Moladah,
27
Hazar-Gaddah, Heshbon, Bet-Pelet,
28
Hazar-Shual, Beersheba, Biziotaya,
29
Baalah Lim, Ezem,
30
Eltolad, Kesil, Hormah,
31
Ziklag, Madmanna, Sansannah,
32
Lebaot, Shilhim, Ain, Rimmon and dem bi twenty-nine big and small towns.
33
Dis na di towns wey dey di lowland: Eshtaol, Zorah, Ashnah,
34
Zanoah, En-Gannim, Tappuah, Enam,
35
Jarmut, Adullam, Soko, Azeka,
36
Shaaraim, Aditaim and Gederah (or Gederotaim) and dem bi fourteen big and small towns.
37
Zenan, Hadashah, Migdal-Gad,
38
Dilean, Mizpa, Jokteel,
39
Lakish, Bozgat, Eglon,
40
Kabbon, Lahmas, Kitlish
41
Gederot, Bet-Dagon, Naamah and Makkedah and dem bi sixteen big and small towns.
42
Libnah, Eta, Ashan,
43
Jeftah, Ashnah, Nezib,
44
Keilah Akzib and Maresha and dem bi nine big and small towns.
45
Ekron and all di towns wey dey near am;
46
from Ekron west, evribody for Ashdod aria and dia towns;
47
Ashdod and doz wey dey near am, plus Gaza with doz wey dey near am, go rish Egypt Stream and di borda for Mediterranean Sea.
48
Dis na di towns for di kountries for hill: Shamir, Jattir, Sokoh,
49
Dannah, Kiriat-Sannah (wey bi Debir),
50
Anab, Eshtemoh, Anim,
51
Goshen, Holon and Gilo and dem bi eleven big and small towns.
52
Arab, Dumah, Eshan,
53
Janim, Bet-Tappuah, Afeka,
54
Humtah, Kiriat-Arba (wey bi Hebron) and Zior and dem bi nine big and small towns.
55
Maon, Karmel, Zif, Juttah,
56
Jezrel, Jokdeam, Zanoah,
57
Kain, Gibeah and Timnah and dem bi ten big and small towns.
58
Halhul, Bet-Zur, Gedor,
59
Maarat, Bet-Anot and Eltekon and dem bi six big and small towns.
60
Kiriat-Baal (wey bi Kiriat-Jearim) and Rabbah and dem bi two towns.
61
Dis na di towns for desert: Bet-Arabah, Middin, Sekakah,
62
Nibshan, di Salt towns and En-Gedi and dem bi six towns.
63
Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 16 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24