bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Joshua 23
Joshua 23
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 24 →
1
E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.
2
So Joshua gada all di pipol, plus di eldas, rulers, judge and leaders kon tell dem sey: “I don old well-well.
3
Una si evritin wey di Oga una God do to di oda nashons and as E take fight for una.
4
Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win.
5
Di Oga una God go drive dem komot for una, so dat una go fit stay dia land just as di Oga una God promise una.
6
“Make una dey strong! Make una dey obey evritin wey dem rite for Moses book with kare, so dat una nor go fall go left or rite,
7
or kon make friend with di remainin nashons. Una must nor use dia god name take make mout or tok about am! Una must nor woship or bow to dem!
8
But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.
9
“For una front, God porshu nashons wey get pawa well-well; nobody fit beat una kon rish today.
10
Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise.
11
Make una dey very kareful! Make una love di Oga wey bi una God!
12
“If una turn from God kon go enter agriment with di remainin towns wey dey near una, den marry some of dem and bi friend with some,
13
den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.
14
“Make una listin, I go soon die. Una know with all una heart and body sey evritin wey God promise sey E go do, E don do am for us!
15
And na so, E don do evritin wey E promise una sey E go do for una, but if una disobey, God go bring all di judgement for una head, until E distroy una from dis good land wey di Oga una God give una.
16
If una go against di Oga una God kovenant wey E kommand make una keep kon follow, woship and dey bow to oda gods, God go vex for una well-well and una go kwik-kwik vanish komot from dis good land wey E give una.”
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 24 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24