bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
1 Chronicles 13
1 Chronicles 13
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 14 →
1
King David koll and tok to di ofisas with
2
Israel pipol sey, “If una and di Oga awa God go like am, den e betta make wi send message go meet awa remainin brodas, priests and Levi pipol for dia towns sey make dem gada kom
3
follow us go karry God Kovenant Box, wey dem abandon thru-out di time wey Saul bi king.”
4
Wetin David tok, kon make di pipol dey happy.
5
So David gada Israel pipol from Shihor River for Egypt go rish Hamat, so dat dem go-go bring God Kovenant Box from Kiriat-Jearim.
6
David and all di pipol kon go Baalah town (wey bi Kiriat-Jearim), for Judah go bring God Kovenant Box wey dey on-top di creature wey get feada. Na God name dem dey koll di box.
7
Dem bring di Kovenant box kom out from Abinadab house, put am for one new truck and na Uzza and Ahio dey guide am.
8
David with all di pipol kon dey dance with dia heart to honor God. Dem sing dey play instrument, harp, drums, cymbals and trumpets.
9
Wen dem rish where dem for dey separate wheat for Kidon, di truck wey dem put di Kovenant Box kon dey shake like sey e won fall, so Uzza kon hold di box make e for nor fall.
10
At wons, God vex kon kill Uzza, bikos e tosh di box.
11
David vex well-well, bikos God kill Uzza, so e koll di place Perez Uzza and na-im dem dey koll am till today.
12
Den David kon dey fear God dat day so e kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box naw?”
13
So David nor karry am go Jerusalem again, instead, e karry am go Obed-Edom wey kom from Gat, house.
14
God Kovenant Box dey Obed-Edom house for three monts, so God bless Obed-Edom family and evritin wey dem get.
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 14 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
Recommended Reading
Commentary
1 Chronicles Commentaries
→
Devotional
1 Chronicles Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→