bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
1 Chronicles 18
1 Chronicles 18
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 17
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 19 →
1
Leta, David attack and win Filistia pipol again kon take Gat town with all en village.
2
E still win Moab pipol kon bigin rule and kollect tax from dem.
3
Afta, David attack King Hadadeza for one Siria land for Zobah near Hamat aria. King Hadadeza bi won take-ova di aria for Eufrates river side.
4
David seize Hadadeza 1,000 shariot, 7,000 men wey dey ride horse and 20,000 sojas wey dey waka with leg. David keep many horse for war kon break di rest ones leg.
5
Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help King Hadadeza, David attack and kill 22,000 sojas.
6
Den David set soja kamp for dia aria kon dey rule and kollect tax from dem. God give David viktory for evriwhere.
7
David karry all di gold shield wey Hadadeza sojas take dey guide diasef for war, go Jerusalem.
8
E still take many bronze from Tibhat and Kun where Hadadeza for dey rule. (Na Solomon use all dis bronze take build tank, kolumns and oda bronze tins for di temple.)
9
Wen King Toi for Hamat hear sey David don win and kollect all Hadadeza sojas,
10
e send en pikin, Joram go greet David, bikos e win King Hadadeza. (King Toi don fight with King Hadadeza well-well before, but e nor fit win am.) Joram karry gold, silva and bronze follow body go.
11
King David dedikate dis tins to God with di gold and silva wey e win from Edom, Moab, Ammon, Filistia and Amalek pipol.
12
Abishai, wey en mama na Zeruaya, kill 18,000 Edom men for Salt Valley.
13
E put guards for Edom. Na King David dey rule all di pipol for der and God make David win all en war.
14
David rule Israel land kon make sure sey dem dey trit en pipol well.
15
Abishai wey bi Joab broda, naim bi di sojas oga and na Jehoshafat wey Ahilud born, dey keep rekord.
16
Ahitub pikin Zadok and Ahimelek wey Abiatar born, na dem bi priests, while Shavsha kon bi seketry for di kourt.
17
Benaya wey bi Jehoiada pikin, naim dey lead David bodyguards and David sons na shiefs ofisas too.
← Chapter 17
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 19 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
Recommended Reading
Commentary
1 Chronicles Commentaries
→
Devotional
1 Chronicles Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→