bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
1 Chronicles 14
1 Chronicles 14
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 13
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 15 →
1
King Hiram for Tyre kon send message go give David sey make dem do business togeda. E still send cedar wood, stones and karpenters make dem take build one palis for David.
2
David know sey na God make am king for Israel and E dey prosper en kingdom and pipol.
3
David marry plenty wifes for Jerusalem and e born many shidren.
4
Di shidren wey dem born for am for Jerusalem na: Shammua, Shobab, Natan, Solomon,
5
Ibhar, Elishua, Elpelet,
6
Nogah, Nefeg, Jafia,
7
Elishamah, Beeliada and Elifelet.
8
Wen Filistia pipol hear sey dem don make David king for Israel, dia sojas gada won kon go fight am. But David hear dia plan, so en and en men kon mash go meet dem.
9
Filistia pipol go skata evriwhere for Refah Valley.
10
So David ask God, “Make I go attack Filistia pipol? Yu go dey with mi?” God ansa, “Yes! Go attack dem, bikos I go dey with yu!”
11
So David attack and win dem for Baal-Perazim. David kon sey, “My Oga God don use mi take distroy my enemies like wota wey dey rush fit force.” So E kon koll di place, “Baal-Perazim.”
12
Wen Filistia pipol dey run, dem leave dia juju, so David orda en pipol make dem burn dem trowey.
13
E nor too tey before Filistia pipol go skata di valley again.
14
Den David ask God again and E sey, “Nor attack dem from dis side, but go pass thru where di Balsam trees dey.
15
And wen yu hear pipol dey mash on-top di trees, make yu attack dem bikos, I go mash go yor front go distroy Filistia sojas.”
16
David kon do as God kommand, so e drive Filistia pipol from Gibeon pass Geza.
17
David story spread go evriwhere and God kon make all di nashons dey fear am.
← Chapter 13
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 15 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
Recommended Reading
Commentary
1 Chronicles Commentaries
→
Devotional
1 Chronicles Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→