bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
2 Chronicles 10
2 Chronicles 10
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 11 →
1
Rehoboam travel go Shekem, bikos Israel pipol don gada for der to make am dia king.
2
Nebat pikin, Jeroboam wey run from Solomon go hide for Egypt, still dey stay der wen e hear dis tin.
3
Dem kon send pesin go koll Jeroboam kom and all of dem go meet Rehoboam kon tell am,
4
“Yor papa, Solomon wiked us kon make us dey do hard work. If yu sorry for us kon komot dis heavy load for awa head, wi promise sey wi go respet yu forever.”
5
Rehoboam ansa, “Afta three days, make una kom back and I go give una my ansa.” So, dem kon go.
6
King Rehoboam ask di old men wey bin dey advise Solomon sey, “Wetin una wont make I tell dis pipol?”
7
Dem ansa am, “If yu wont make dis pipol serve yu well; give dem ansa wey dem go like and dem go use all dia heart serve yu forever.”
8
But King Rehoboam nor listin to dem, instead e go ask di yong men wey bi en mate,
9
“Wetin una wont make I do? Wetin I go tell dis pipol wey sey make I sorry for dem?”
10
Dem ansa, “Make yu tell dem, ‘I hard pass my papa, Solomon!’
11
Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard well-well. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
12
Afta three days, Jeroboam and di pipol go meet King Rehoboam, just as e tell dem.
13
Di king nor listin to di old pipol advise, instead e tok to dem anyhow, just
14
as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work hard well-well. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”
15
Dis na how God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.
16
Wen di pipol si sey di king nor won listin to dem, dem kon bigin shaut, “Make David and en family get out! Wetin dem don do for us before? Israel pipol; make wi dey go house! Make King Rehoboam kare for ensef!” So Israel pipol bigin argue among diasef
17
kon waka leave Rehoboam make e bi king to only doz wey dey Judah aria.
18
So King Rehoboam send Adoniram wey bi di workers oga go meet Israel pipol, but dem stone am die and wen King Rehoboam hear wetin happen, e kwik-kwik enter en shariot kon run go Jerusalem.
19
And na since den Israel pipol for nort bigin fight against David kingdom.
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 11 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36