bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
2 Chronicles 15
2 Chronicles 15
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 16 →
1
God Spirit enter Zabud wey bi Oded pikin.
2
E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.
3
For sometaim naw, Israel pipol nor get di true God or priest wey go tell dem di law or wetin to do.
4
Bikos of dia sofa, dem kon turn go meet Israel God. Dem find am until dem si am.
5
For dat time, nobody fit travel as e like, bikos trobol dey evriwhere for di land.
6
One town dey opress anoda town; nashon dey opress nashon, bikos na so God wont am.
7
But as for una, make una dey strong and nor fear, bikos God go reward una work.”
8
Wen King Asa hear dis word and wetin Profet Oded tok, en heart kon strong. E distroy all di juju for Judah and Benjamin land and for all di towns wey e take from Efraim hill. So e ripair God altar wey dey di temple front.
9
E gada all Judah and Benjamin pipol, plus di pipol wey dey for Efraim, Manasseh and Simeon tribe wey dey with am. Many pipol from Israel kom stay der wen dem si sey di Oga God dey with am.
10
For fifteen years wen Asa don bi king, dem kon gada for Jerusalem for di third mont.
11
Dat time, dem offa some tins wey dem karry from war as sakrifice give God and na 700 melu head and 7,000 sheep, dem use.
12
Dem gri sey na only di Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem go serve with dia whole heart.
13
Dem kon kill both yong and old; boys or girls wey nor gri serve God.
14
Dem promise sey dem go serve God kon dey blow trumpet to show sey dem mean wetin dem dey tok.
15
Judah pipol happy, bikos dem make dis promise with all dia heart. Dem find God with dia heart and E hear dia kry kon save dem.
16
King Asa remove en grand-mama, Maaka from en pozishon as kween mama, bikos e make Asherah en juju. King Asa kut di juju kon burn am to pieces for Kidron Valley.
17
Even doh Asa nor skata all di juju for di land, e obey God till e die.
18
E put all di tins wey Abijah en papa, dedikate give God for di temple, with di gold and silva.
19
War nor kon dey again until di thirty-fift years wen Asa dey rule.
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 16 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36