bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
2 Chronicles 31
2 Chronicles 31
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 30
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 32 →
1
Afta di feast, Israel pipol for Judah kon go skata di pilas, Asherah juju pole, all di high place and altar where dem for dey serve juju for Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes. Den all of dem kon go back to dia house.
2
King Hezekaya put priest and Levi pipol sey make dem dey burn sakrifice, serve, give ofrins, tank, praiz and dey woship God for en temple.
3
Di king give some of en animals as burnt sakrifice, with di morning and evening burnt sakrifice and di sakrifice wey dem dey burn for Sabat Day, New Moon and any oda time wey dem rite for God Law Book.
4
E give orda sey make di pipol for Jerusalem bring dia own part wey dem go share give di priest and Levi pipol, so dat dem go obey God kommand.
5
Wen dem give di orda, Israel pipol bring dia grain, wine, olive oil, honey and all wetin dem get for dia farm. Dem bring one for evry ten tins wey dem get and dem plenty well-well.
6
Israel and Judah pipol wey dey stay Judah towns bring one from evry ten melu and sheep, with one from evry ten holy tins wey dem get, so dat dem go dey klean for God eye. Wetin dem bring plenty well-well.
7
For di third mont, dem kon gada all wetin dem bring till di sevent mont.
8
Wen King Hezekaya with en ofisas si wetin dem gada, dem praiz God kon bless di pipol.
9
Wen King Hezekaya ask di priest and Levi pipol about wetin dem gada,
10
Zabud from Zadok family wey dey head all di priests kon sey, “Since dem bigin bring all dis tins kom God Temple, wi dey get plenty to chop and e dey remain. God don bless en pipol, naim make all dis ones still remain.”
11
King Hezekaya give orda make dem prepare store room for di temple. As dem do am finish,
12
dem kon take all di tins, di tithe and di holy tins enter inside. Kenanaya wey kom from Levi, naim bi oga for dis tins and na en broda Shimei dey help am.
13
Jehiel, Azazaya, Nahat, Asahel, Jerimot, Jozabad, Eliel, Ismakaya, Mahat and Benaya dey work under Kenanaya and en broda Shimei wey bi di oga for God Temple, bikos na so King Hezekaya and Zabud wey bi oga for di temple, wont make e bi.
14
Imnah pikin Kore, wey kom from Levi tribe, dey guide di east side for di temple and na-im still dey kollect and divide di gifts wey pipol bring kon give God.
15
For di town wey priests dey stay, Eden, Mijamin, Jeshua, Shemaya, Amaraya and Shekanaya dey help Kore share di tins give di oda priests akordin to dia work and age.
16
Dem share give di men wey don old pass thirty years wey dem rite dia name put for di family rekord and doz wey go enter God Temple go serve and do dia evriday work.
17
Dem share di tins give di priests akordin to dia family name for di rekord kon give Levi pipol wey don rish and pass twenty years, akordin to di work wey dem give dia group.
18
Dem share food give all di family wey dem rite for di history book, plus di small shidren, wifes, sons and dotas. Bikos all dis ones dey always santify demsef.
19
Dem choose some men from di priests from Aaron shidren-shidren towns, so dat dem go share di food give all di priests and doz for Levi family rekord.
20
For Judah, King Hezekaya do only tins wey dey rite, korrect and good for God eye.
21
Evritin wey e do to take serve God well for en temple and to follow God laws and kommands, Hezekaya do dem with e whole heart and bikos of dis, God kon make am prosper.
← Chapter 30
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 32 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36