bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Hosea 5
Hosea 5
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 4
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 6 →
1
“Una wey bi priest, make una listin! Israel pipol, make una listin well-well! Una wey kom from royal family, make una listin well-well too bikos I dey kom judge una. Una lead di pipol enter trap bikos all of una dey woship juju for Mizpa and for Mount Tabor.
2
Una don dig one deep pit for where una dey woship juju, so I go ponish all of una.
3
I know Israel pipol well-well; di wiked tins wey dem do, nor go fit hide from mi. Dem don turn ashawo kon make demsef dirty.
4
“Dia wikedness nor allow dem turn kom meet mi wey bi dia God, bikos di juju wey dem dey serve, dey shark dem and dem nor won know mi at-all.
5
Israel pipol sturbones dey tok against dem. Dia sin dey make dem kick stone fall and Judah pipol dey fall with dem too.
6
Even wen dem kom sakrifice animals give God make E for favor dem, dem nor si am bikos E don turn from dem.
7
Dem nor dey faithful to God and dem born shidren wey nor know dia papa. So naw, di new moon festival go distroy dem and dia land.
8
“Make una blow di war trumpet for Gibeah! Make una blow di wiso for Rama! Make una blow di trumpet for Bet-Aven! Benjamin pipol make una shake with fear!
9
Bikos Judgement Day dey kom wen dem go distroy Israel pipol. Wetin I dey tok naw, go really happen to una!
10
“God sey, “Judah leaders bi like pipol wey dey kut pipol land take. So I go pour my vexnashon like heavy rain for dia body.
11
Dem go opress and judge Israel pipol anyhow, bikos dem don make up dia mind to serve juju.
12
I go distroy Israel kon turn Judah land to where dem dey trowey dirty put.
13
Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.
14
I go attack Israel and Judah pipol like lion. Mi mysef go tear dem to pieces kon karry dem komot der and nobody go fit save dem.
15
I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”
← Chapter 4
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 6 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14