bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Hosea 6
Hosea 6
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 5
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 7 →
1
Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.
2
Afta two or three days, E go heal us, so dat wi go fit stay for en present again.
3
So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.
4
But God tell dem, “Israel and Judah pipol, wetin I won take una do? Bikos di love wey una get for mi dey kwik disappear like dew for morning; like dew wey dey vanish wen day dey break.
5
Na dis make mi send my profet kom give una di judgement and distroshon message. Just as day dey break for morning, na so too, my judgement go kom meet una.
6
Nor bi animals sakrifice I wont, but na una love wey nor dey die. E betta make my pipol know mi, dan all di burnt ofrin wey dem dey give mi.
7
But just like Adam, my pipol sef break di kovenant wey I make with dem.
8
Na wiked pipol full Jabesh-Gilead town and na pipol blood kover all dia street.
9
Di priests dem bi like tif wey hide for bush bikos one attack pesin. Dem dey kill pipol for di road wey dem dey pass go Shekem and dem still dey do many wiked tins!
10
I don si wiked tins for Israel: Judah pipol don make demsef dirty, bikos dem dey woship juju.
11
As for una Judah pipol, I don set time wen I go take ponish una bikos of una sins, even doh sey I go make my pipol prosper again.”
← Chapter 5
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 7 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14