bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jonah 2
Jonah 2
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 1
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 3 →
1
As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.
2
E sey, “I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi. Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey, so make Yu go kom help mi and hear my prayers.
3
Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.
4
Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’
5
Di wota kover and almost kill mi. Naw, I don sink enter di sea. Even di leaf dem wey dey di sea, don tie my head.
6
I sink go under di mountins kon enter inside one place where I go bi prisona forever. But Yu, my God don take mi komot from di pit.
7
Wen I tink sey my life don dey finish, I kon pray give Yu and Yu hear mi from yor holy temple.
8
Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.
9
But as for mi, I go sing praiz Yu; I go offa sakrifice give Yu kon do wetin I promise, bikos na only Yu fit save mi!”
10
Den God kon kommand di fish make e go vomit Jonah put for dry land.
← Chapter 1
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 3 →
All chapters:
1
2
3
4