bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jonah 3
Jonah 3
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 4 →
1
God kon tell Jonah for di sekond time,
2
“Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol my message.”
3
So Jonah obey God kon go Nineveh. (Nineveh na one big town and e go take three days to waka round am!)
4
For di day wen Jonah enter di town, e kon tell di pipol, “Afta forty days, God go distroy Nineveh finish!”
5
Nineveh pipol bilive God message, so dem kon sey make evribody fast and wear sak and evribody, both small and old, do wetin dia leaders tell dem.
6
Wen dia king hear di news, e get up from en throne, remove en fine klot, wear sak kon sidan for ashes.
7
E kon kommand, “For inside dis kingdom, Nineveh, mi and all my ofisas don gri sey: ‘Make nobody or animal, chop or drink anytin.
8
Make evribody and dia animals wear sak kon pray well-well to God, den turn from dia sin go meet am.’
9
May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!”
10
So wen God si wetin dem dey do: sey dem don really turn kom meet am, E kon shange en mind and E nor ponish dem again, just as E bin won do.
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 4 →
All chapters:
1
2
3
4