bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jonah 4
Jonah 4
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 3
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
1
Jonah nor happy bikos of wetin happen, so e kon dey vex.
2
Den e kon dey komplain to God, “My God, before I komot from my kountry, I know sey dis na wetin Yu go do? Na dis tin make mi try to run go Tarshish! I know sey Yu dey sorry and kare for pipol and Yu get patient, dey kind and instead of Yu to ponish pipol, Yu always dey ready to forgive dem.
3
So my God, make Yu just kill mi. E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”
4
Den Oga God kon ansa Jonah, “Na wish rite yu get to dey vex?”
5
So Jonah kon go sidan for di east side for di town. E arrange one small place for der kon sidan dey wait to si wetin go happen to di town.
6
Den God make one small plant grow kover Jonah, so dat e go fit rest well. So Jonah happy well-well, bikos of di plant.
7
But di next day, God send one worm kom chop, distroy and kill di plant.
8
Wen sun start to shine, God kon send one hot breeze kom from east. Di sun dey shine for Jonah head and e nearly faint. So as Jonah dey vex, bikos di plant wey kover en head don die, e kon sey, “E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”
9
But God tell am, “Wish rite yu get to dey vex bikos of di small plant?” Jonah ansa, “I get evry rite to vex till I die!”
10
Den God tell am, “If yu dey vex sey I kill dis plant wey grow for only one nite kon die di next day; plant wey yu nor do anytin for or make grow,
11
den why yu feel sey I know go sorry for Nineveh town wey dey for darkness? Place where en pipol many pass one hundred and 20,000 and wey get many animals.”
← Chapter 3
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
All chapters:
1
2
3
4