bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Leviticus 15
Leviticus 15
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 16 →
1
Den God tell Moses and Aaron:
2
“Make una go tell Israel pipol sey, ‘Wen man discharge, e go dey unklean, bikos of dat tin.
3
Weda di tin dey komot from en body or e don stop, di man don dey unklean.
4
Any bed wey e liedan or sidan put, don dey unklean.
5
“ ‘Anybody wey tosh di bed wey di man liedan put must go wosh en klot kon baf with wota and di pesin go dey unklean till evening.
6
Anybody wey sidan for di chair wey di pesin wey discharge sidan put before, must wosh en klot, baf with wota and e go dey unklean till evening.
7
Anybody wey tosh am must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening.
8
If di pesin wey discharge, spit for pesin wey dey klean body, dat pesin must go wosh en klot kon baf, but e go dey unklean till evening.
9
Anytin wey dem dey ride or chair wey di pesin sidan put go dey unklean.
10
Anybody wey tosh wetin e sidan put go dey unklean till evening. Anybody wey karry wetin di pesin sidan put must go wosh en klot, baf, but e go still dey unklean till evening.
11
Anybody wey tosh di man wey discharge and e nor wosh en hand, must go wosh en klot and baf with wota, but e go still dey unklean till evening.
12
If di man tosh klay pot, dem must break am and if na plate wey dem make with wood naim di man tosh, dem must wosh am.
13
“ ‘Wen di man wey discharge don klean, e go wait for seven days, wosh en klot kon baf with fresh wota and e go dey klean.
14
For di eight day, e go take two dove or two pijin kom di tent gate for God present kon give dem to di priest.
15
Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin. Na like dis di priest go take make sakrifice for di man for God eye.
16
“ ‘Wen di man discharge, e must go baf, but e go dey unklean till evening.
17
Anytin wey dem do with klot or leda and di discharge tosh am, dem must wosh am and di tin go dey unklean till evening.
18
Afta di man don sleep with di woman finish, di man and di woman must go baf and dem go dey unklean till evening.
19
“ ‘Wen woman dey mestrate, e go dey unklean for seven days. Anybody wey tosh am go dey unklean till evening.
20
Anytin wey e sidan or liedan put wen e dey mestrate, go dey unklean.
21
Anybody wey tosh di bed wey e sleep put must wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening.
22
Anybody wey tosh di chair wey e sidan put must go wosh e klot, baf with wota and e go dey unklean till evening.
23
If anytin dey for di bed or di chair wey e sidan put, wen e tosh am e go dey unklean till evening.
24
If man sleep with am for dat time, e go dey unklean for seven days and any bed wey di man sleep put, go dey unklean too.
25
“ ‘Wen di woman dey mestrate before di rite time or if di blood still dey flow wen e suppose don stop, e go dey unklean as far as di blood still dey flow.
26
Any bed wey e sleep or anytin wey e sidan put, go dey unklean for dat time.
27
Anybody wey tosh dem, dey unklean and e must go wosh en hand kon baf, but e go dey unklean till evening.
28
“ ‘Wen di blood don stop, di woman go wait for seven days, den e go dey klean.
29
For di eight day, e go take two dove and two pijin go give di priest for di tent gate for God present.
30
Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin, na like dis di priest go take make sakrifice before God.’ ”
31
God tell Moses make e warn Israel pipol about dia dirty life, so dat dem nor go spoil God house wey dey di kamp centre. If dem do am, dem go die.
32
“Dis law na for men wey dey discharge,
33
woman wey dey mestrate or man wey sleep with woman wey nor klean.”
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 16 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
Recommended Reading
Commentary
Leviticus Commentaries
→
Devotional
Leviticus Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→