bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Leviticus 17
Leviticus 17
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 18 →
1
God tell Moses:
2
“Go tell Aaron, en sons and Israel pipol sey: ‘Dis na wetin God tok:
3
Anybody wey kill animal like melu, sheep or goat among Israel house for dia kamp
4
and e nor take am go di tent gate as ofrin to God, e don kill bi dat and e nor go dey among Israel pipol again.
5
Like dis, wetin Israel pipol won sakrifice for di open field to God for di tent gate, dem go gi-am to di priest, den e go sakrifice am as peace ofrin to God.
6
Di priest go pour di blood for God altar for di tent kon burn di fat and God like dis ofrin smell.
7
So make di pipol nor sin against God kon offa sakrifice give dia goat juju. Israel pipol must keep dis law forever.
8
“ ‘Any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land wey offa burnt ofrin or any oda sakrifice
9
as ofrin to God for any place escept di tent gate, nor go dey among God pipol again.
10
“ ‘If any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land chop meat wey still get blood, God go turn against am and e nor go dey among God pipol again.
11
Bikos na blood bi life for di body, naim make God sey dem must pour all di blood for di altar to take santify pipol. Blood wey bi life, dey remove sin.
12
Na dis make God tell Israel pipol and all di strenjas wey dey stay for dia land sey make dem nor chop meat wey still get blood.
13
“ ‘If anybody from Israel or strenja wey dey di land kill any animal or bird wey klean, e must pour di blood for groun kon kover am with san.
14
Na blood dey give life and na dis make God tell Israel pipol make dem nor chop meat wey still get blood and anybody wey do am, nor dey among God pipol again.
15
Anybody wey kom from Israel or strenja wey chop animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening.
16
If e nor wosh e klot or baf, e go sofa di ponishment.’ ”
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 18 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27