bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Leviticus 24
Leviticus 24
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 23
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 25 →
1
God tell Moses:
2
“Make yu kommand Israel pipol make dem bring pure olive oil wey fine well-well kom put for di lamp wey dey di tent, so dat lite go dey di temple.
3
For evening, Aaron go lite am till morning for God present outside di curtain for di Kovenant Box front wey dey for di holy place. Dis law go dey forever.
4
Aaron go kare for di lamp wey dey di lampstand and e go always dey arrange am for God present.
5
“Una must take twelf kilogram of flower kon bake twelf bread,
6
una go put di bread for two row, six-six for one row on-top di tabol wey dem kover with gold, wey dey God present.
7
Una must put pure incense for each row to dey remember di bread and e go bi gift ofrin to God.
8
For each Sabat Day, Aaron go always dey arrange am before God; dis na Israel pipol work forever.
9
Na Aaron and en sons get di bread and dem go chop am for di holy aria, bikos na holy food wey dem offa to God.”
10
E get one man, en papa kom from Egypt and en mama name na Shelomit wey Dibri from Dan tribe for Israel, born. For di kamp, di man kon dey kworel with one Israel man.
11
As dem dey fight, di Israel woman pikin kon curse God name, so dem take dem go meet Moses. (En mama name na Shelomit wey bi Dibri pikin from Dan tribe.)
12
Dem put am for prison dey wait for God to tell dem wetin dem go do.
13
Den God tell Moses:
14
“Make yu bring di man wey curse mi kom out from di kamp, anybody wey hear am dey curse go put dia hand for en head to bear witness against am sey e dey guilty and evribody for Israel go stone am till e die.
15
Make yu tell Israel pipol sey anybody wey curse God, go sofa di ponishment for en sin
16
and pesin wey use God name anyhow, must die. Israel pipol go stone am weda na strenja e bi or not; anybody wey use God name anyhow, go must die.
17
If pesin beat pesin die, dem must kill dat pesin too.
18
If pesin beat animal die, di pesin must give anoda animal to di pesin wey en animal don die, bikos di law sey, ‘Una go give life-for-life.’
19
If pesin wound en neighbour wey bi Israel pesin; just as e do am, na so dem go do am back!
20
If e break en neighbour bone, dem go break en bone too; if e blind pesin eye, dem go blind en own too; if e remove pesin tit, dem go remove en own too. Anytin wey pesin do en neighbour, dem go do am back.
21
Pesin wey kill any animal, go replace am. But pesin wey kill pesin, go die too.
22
Dis law na for all of una, weda yu bi Israel pesin or strenja. Na mi bi di Oga una God.”
23
Wen Moses don tell Israel pipol evritin finish, dem take di man go outside di kamp kon stone am die. Like dis, Israel pipol kon do as God kommand Moses.
← Chapter 23
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 25 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27