bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
1 Samuel 11
1 Samuel 11
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 10
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 12 →
1
Nahash dem wey bi Ammon pipol kon mash dey go fight Jabesh pipol. All di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Make wi make peace with una and wi go serve una.”
2
But Nahash pipol wey bi Ammon pipol kon ansa, “Di only way wey wi fit make peace with una, na if una agri make wi blind evribody rite eye and dis go bi disgrace for Israel pipol!”
3
Di leaders for Jabesh kon tell dem, “Make una give us seven days, so dat wi go send message go evriwhere for Israel. If nobody dey to diliver us, den wi go do as una wont.”
4
Wen di pesin wey dem send rish Gibeah (where Saul dey stay) kon tell dem wetin dey happen, all di pipol kon bigin kry.
5
Naw, Saul just dey bring en animals kom back from farm. Wen Saul si di pipol, e kon ask, “Wetin happen? Wetin make una dey kry?” Dem kon tell am about di men for Jabesh.
6
As Saul hear dis word, God Spirit enter en body and e kon dey vex.
7
Saul kut two melu to many parts kon tell some pipol make dem karry di parts go evriwhere for Israel sey, “Anybody wey nor gri follow Saul and Samuel, make e know sey na so dem go do en melu!” Den God make fear enter di pipol and dem kon go fight as one family.
8
Wen Saul kount all of dem for Bezek, Israel pipol na 300,000 strong men, while Judah men, na 30,000.
9
Dem kon tell di pesin wey dem send kom, “Dis na wetin yu go tell Jabesh: ‘Tumoro, una go dey save wen di sun don dey shine well-well.’ ” Wen di messenja go tell Gilead pipol di message, belle sweet dem well-well.
10
Di men for Jabesh kon tell Nahash pipol, “Tumoro, wi go kom surenda to una and make una trit us as una like.”
11
Di next day, Saul kon divide di pipol into three group. Dem go Ammon pipol kamp for morning kon kill all of dem until aftanoon. And di pipol wey remain, run skata go difren place.
12
Den di pipol kon tell Samuel, “Na who bi di pipol wey dey ask sey, ‘So Saul go kon rule us?’ Tell us who dem bi, so dat wi go kill all of dem!”
13
But Saul ansa, “Una nor go kill anybody today. Bikos God don make Israel pipol win!”
14
Samuel tell di pipol, “Make una kom make wi go Gilgal go crown Saul.”
15
So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.
← Chapter 10
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 12 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31