bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
1 Samuel 7
1 Samuel 7
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 6
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 8 →
1
Den, Kiriat-Jearim pipol kom karry di Kovenant Box go Abinadab house wey dey di hill. Dem kon santify Abinadab pikin, Eleazar, so dat e go dey guide di box.
2
So di Kovenant Box stay for Kiriat-Jearim for twenty years. For dis time, Israel pipol dey kry give God make E help dem.
3
Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”
4
So di pipol remove all Ashtoret gods and juju and dem kon dey serve only God.
5
Den Samuel sey, “Make una gada evribody for Israel kom Mizpa and I go pray to God for una.”
6
Afta dem don gada for Mizpa, dem kon draw wota pour put for God front. Dem nor chop for dat day and dem kon konfess all dia sins for der dey sey, “Wi know sey wi don sin against God.” So Samuel pray for Israel pipol for Mizpa.
7
Wen Filistia pipol hear sey Israel pipol don gada for Mizpa, dia leaders kon gada dia sojas make dem for go fight Israel pipol. As Israel pipol hear sey Filistia pipol dey kom, fear kon katch dem.
8
So dem kon tell Samuel, “Abeg! Make yu still pray to di Oga awa God, so dat E go save us from Filistia pipol!”
9
So Samuel take one small sheep kon offa am as one full ofrin to God. Samuel pray to God for Israel pipol and God kon ansa am.
10
As Samuel dey burn di ofrin, Filistia pipol dey kom fight Israel pipol. But for dat day, God kon send tonda from heaven go meet Filistia pipol. E make dem fear well-well and Israel pipol kon kill dem well-well.
11
Den, Israel men kon from Mizpa porshu Filistia pipol kon kill dem rish one aria for Bet-Car.
12
Samuel put one stone between Mizpa and Shen. E koll di place Ebeneza, bikos e sey, “Na God help us rish here.”
13
So Israel pipol win Filistia pipol and dem nor fight Israel pipol again. Thru-out Samuel time, God dey against Filistia pipol.
14
All di towns wey Filistia pipol don take from Israel before, Israel pipol kon take dem back from Ekron go rish Gat. Israel pipol take dia aria from Filistia pipol hand and peace kon dey between Israel and Amor pipol.
15
So Samuel lead Israel pipol till e die.
16
Evry year, e dey travel go Bethel and from der, e go-go Gilgal till e rish Mizpa kon dey judge Israel pipol for evriwhere.
17
Den e go kom back to Rama, bikos en house dey der. E still dey judge Israel pipol for der and e build one altar for der wey dem for dey woship God.
← Chapter 6
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 8 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31