bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
1 Samuel 3
1 Samuel 3
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 4 →
1
Samuel kontinue to serve God under Eli di priest and for dat time, God nor dey too give dem message or vishon.
2
One nite, Eli wey nor dey si well-well again dey sleep for en room
3
and Samuel dey sleep for where di Kovenant Box dey. Before day break as di lamp still dey on
4
God kon koll Samuel and e ansa, “Na mi bi dis!”
5
Den e run go meet Eli kon sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.” But Eli sey, “I nor koll yu. Make yu go back go sleep.”
6
Den God koll again, “Samuel!” So Samuel get up kon go meet Eli sey, “Si mi here, yu dey koll mi.” But Eli ansa, “I nor koll yu my pikin. Make yu go back go sleep.”
7
Naw Samuel neva still know God; e neva know wen God dey tok.
8
Den God koll Samuel for di third time. E get up go meet Eli sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.” Eli kon know sey na God dey koll di boy.
9
So e kon tell Samuel, “Go back go sleep. Wen yu hear di vois koll yu again, make yu sey, ‘Oga, tok to mi, yor savant dey listin.’ ” So Samuel kon go back go sleep.
10
Den God kom near and koll am as before, “Samuel! Samuel!” So Samuel ansa, “Tok to mi, yor savant dey listin!”
11
God tell Samuel, “Look! I won do sometin for Israel; wen anybody hear am, en two ear go dey shine like star.
12
For dat day, I go ponish Eli family as I don tell am before and evritin wey I tok from biginnin go rish end, go happen!
13
Make yu tell am sey, I won judge en family forever, bikos of di sins wey en ensef know about. Bikos en boys shidren dey curse God and e nor stop dem.
14
So, I don swear for Eli house sey, ‘Dem nor go fit use sakrifice or korn ofrin take forgive di sin wey Eli family kommit.’ ”
15
So Samuel sleep until day break. Den e open di door for God house. But Samuel dey fear to tell Eli di vishon.
16
Eli koll Samuel kon sey, “Samuel my pikin!” Samuel ansa, “Si mi here.”
17
Eli ask am, “Na wetin God tell yu? Nor hide am from mi, if not God go ponish yu well-well!”
18
So Samuel tell Eli evritin. E nor hide anytin from am. Eli kon sey, “Make God do wetin E like.”
19
Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen.
20
Evribody for Israel from Dan go rish Beersheba know sey Samuel na real profet from God.
21
God kon dey show ensef for Shiloh, di place wey e for appear to Samuel kon tok to am. And wen Samuel tok, evribody for Israel dey listin to am.
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 4 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31