bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
1 Samuel 31
1 Samuel 31
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 30
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
1
Naw, Filistia sojas dey fight Israel sojas. Di men for Israel run from Filistia sojas and many of dem die for Mount Gilboa.
2
Filistia sojas kon katch and kill Saul three sons wey bi Jonatan, Abinadab and Malki-Shua.
3
Saul ensef even dey where di war for strong pass and dem kon shot am with arrow and di wound bad well-well.
4
So, Saul kon tell en savant wey dey karry en swod sey, “Draw yor swod make yu stab mi, so dat Filistia sojas wey dem nor sekonsaiz, nor go kill mi.” But di savant nor gri stab am, bikos e dey fear. So Saul take di swod kon kill ensef.
5
Wen di savant si sey Saul don die, en too kon take en own swod take kill ensef.
6
So Saul, en three sons, en savant and all en men kon die dat day.
7
Wen Israel men wey dey di valley and di oda side for Jordan River si sey all Israel men don die and Saul and en shidren don die too, dem kon run komot di town. So Filistia sojas kom take-ova di town.
8
Di next day, as Filistia sojas dey kollect tins from di dead body dem, dem kon si sey Saul and en three sons don die for Mount Gilboa.
9
Dem kut Saul head komot kon take en tins. Dem kon send pesin make e go tell evribody for dia juju temple and among dia pipol sey Saul and en shidren don die.
10
Dem put Saul swod for Ashtoret temple kon hang en body for Bet-Shan wey bi di town wall.
11
Wen Jabesh for Gilead pipol hear wetin Filistia pipol do with Saul body,
12
all dia sojas kon travel for nite go der. Dem karry Saul and en sons dead body from di town wall kon go back to Jabesh where dem for beri dem.
13
Dem take di bones kon beri dem under di tamarisk tree for Jabesh; den dem kon fast for seven days.
← Chapter 30
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31