bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Deuteronomy 17
Deuteronomy 17
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 18 →
1
Make una nor sakrifice any animal wey nor well or get problem give di Oga una God, bikos dat kind tin dey make am vex.
2
Wen una don dey stay di town wey di Oga una God go give una, if one man or woman among una do bad tin for God eye kon go against en kovenant,
3
bikos e go serve anoda god or woship di sun, moon, star or di pawas for heaven, tins wey I sey make una nor do,
4
wen una hear about dat kind tin, make una shek di matter well-well. If na true sey dem do dis bad tins for Israel,
5
den make una take di man or woman wey kommit dis sin go outside di town gate kon stone am die.
6
But make una nor ever kill pesin, bikos of wetin one pesin tok. Two or three pesin must tok di same tin, before una go fit stone pesin die.
7
Di pipol wey tok about di tins wey di pesin do, na dem go first stone di pesin, before oda pipol go join dem. Like dis, una go stop wiked and evil tins among una.
8
If matter too strong for una to judge; matter like to kill pesin or matter wey koncern propaty or wahala for village, make una karry doz kind matter go di place wey di Oga una God don choose.
9
Una go-go meet di Levi priest or di judge wey dey on duty. Dem go hear di kase kon give judgement.
10
Una must do as dem judge for di place wey God choose. Una must do just as dem tok.
11
Afta dem don read di law kon pass judgement, una must do anytin wey dem tok; make una nor try to shange wetin dem tok at-all.
12
Anybody wey nor gri obey wetin di judge or di priest wey dey ripresent di Oga una God tok, una must kill dat pesin. Like dis, una go end bad and wiked tins for Israel.
13
Den wen all di pipol hear am, dem go fear to do wiked tins.
14
Wen una rish di land wey di Oga una God dey give una and una don take and dey stay inside, den una sey, “Like all di kountries wey dey around us, na so too wi go selet king for awasef,”
15
Una must selet di king wey di Oga una God go choose. Una go choose king from among unasef. Make una nor choose pesin wey nor kom from Israel.
16
Make di king nor build big house where e go put horse, or make di pipol go back to Egypt go buy horse, bikos God don sey, “Make una nor go back to Egypt.”
17
Make di king nor marry many wife for ensef, bikos dem go turn en heart from di Oga una God. Make e nor gada money, silva or gold for ensef.
18
Wen e sidan for di throne as king, make e kopy dis kommand put for book for di Levi priest present.
19
Make e always keep dat kopy with am evriday as long as e dey alive. Like dat, e go learn how to fear di Oga en God as e dey obey all di laws and kommand.
20
As e dey read am evriday, e nor go dey proud and e nor go do like sey e important pass evribody. Dis nor go let am turn from dis kommand at-all. And e go make en and en shidren-shidren reign as king for Israel forever.
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 18 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34