bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Deuteronomy 8
Deuteronomy 8
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 7
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 9 →
1
Make una make sure sey una dey obey all di kommandment wey I dey give una today. Den una go get long life kon many as una enter and stay for di land wey God promise sey E go give una grand-grand papa.
2
Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.
3
True-true! E make una dey honbol thru honga kon dey give una food wey una nor know (manna) make una chop. E do dis to tish una sey human being nor nid only food, but dem still dey alive bikos of wetin God tok.
4
For dis forty years, una klot nor even tear and una leg nor get sore at-all.
5
Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good.
6
So make una obey di kommand wey di Oga una God give una kon do as E tok and always dey fear am.
7
Bikos di Oga una God dey take una enter one betta land; land wey get betta river and wota, with fountain wey dey flow for di valley and hill.
8
Betta land wey get wheat, barley, vines, fig trees, pomegranates, olive oil and honey;
9
land where una go for chop as una like and una go get evritin. Betta land where stones bi like iron and una go fit make koppa from en hills.
10
Una go chop beleful kon praiz di Oga una God, bikos of di good land wey E give una.
11
Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today.
12
Bikos wen una go don get propaty well-well kon build many fine house to stay
13
and get many animals and many silva and gold, plus evry oda tin,
14
make una nor kon dey do like sey una too important, den forget di Oga una God wey bring una kom out from Egypt where una for bi slaves before.
15
Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon
16
feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol.
17
E do all dis tins, so dat una nor go kon dey tell unasef sey, “Na my own pawa and work, I take get all dis tins.”
18
Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.
19
But if una forget di Oga una God for evritin kon dey follow oda gods, dey woship and bow for dem, I go tell una today sey, God go really distroy una.
20
Just like di pipol wey God won distroy for una, na so too E go do to una, bikos una nor gri follow en kommand.
← Chapter 7
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 9 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34