bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Deuteronomy 27
Deuteronomy 27
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 26
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 28 →
1
Den Moses and di eldas for Israel kommand di pipol sey: “Make una obey all di kommand wey I dey give una today.
2
Wen una cross Jordan River kon enter di land wey di Oga una God dey give una, make una gada some big stones kon pash dem.
3
Wen una don cross di river won kon enter di land wey milk and honey full, wey di Oga dey give una, just as una grand-grand papa God promise una, make una rite all dis kommand put for di stones.
4
Wen una don cross Jordan River, make una gada di stones for Mount Ebal kon pash dem, just as I dey kommand una today.
5
Den for der, make una build altar for di Oga una God and make una nor use anytin take kut dem at-all.
6
Una go build di Oga una God altar with betta stones; nor bi with ones wey dem kut, den una go offa burnt ofrin for der give di Oga una God.
7
Una go still offa fellowship ofrin kon chop dem for der as una dey happy for di Oga una God present.
8
Una must rite all dis kommand for di stone and una go rite am as evribody go fit take si am.”
9
Den Moses and Levi priests kon tok to Israel pipol: “Israel pipol, make una kwayet and listin! Today, una don bi di Oga una God pipol.
10
So una must obey di Oga una God as una dey keep all dis kommand and laws wey I dey give una today.”
11
Dat day, Moses still tell dem:
12
“Wen una cross Jordan River, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Josef and Benjamin tribe must stand on-top Mount Gerizim kon bless di pipol.
13
And Reuben, Gad, Asher, Zebulun, Dan and Naftali tribe go stand on-top Mount Ebal kon curse any tribe wey nor follow God kommand.
14
“Den Levi tribe go shaut give Israel pipol sey:
15
‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
16
Anybody wey nor respet en papa and mama, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
17
Anybody wey tif en neighbour propaty or kut en neighbour land join e own, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
18
Anybody wey go show blind man wrong road, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
19
Strenjas, pesin wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die, if anybody nor judge dia kase well, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
20
Anybody wey sleep with en papa wife, na curse go follow am, bikos e nor gri honor en papa. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
21
Anybody wey go sleep with animal, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
22
Anybody wey sleep with en sista, weda na en papa or mama pikin, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
23
Anybody wey sleep with en wife mama, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
24
Anybody wey hide go kill en neighbour, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
25
Anybody wey kollect money to kill pesin wey nor do anytin, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
26
Anybody wey nor gri obey or keep dis law and kommand, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.” ’ ”
← Chapter 26
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 28 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34