bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Deuteronomy 30
Deuteronomy 30
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 29
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 31 →
1
I don give una choice to choose between di blessing and di curse. Wen all dis tins don happen to una and una dey stay for di nashons where di Oga una God skata una go, una go remember di choice wey I give una.
2
If una and una shidren-shidren turn kom meet God kon obey all en kommand wey I dey give una today, with una heart and soul,
3
den di Oga una God go sorry for una. E go bring una kom back from di kountries wey E bin skata una go kon make una prosper again.
4
Even if una skata for evriwhere for di eart, di Oga una God go gada and bring una kom back to una land.
5
Di Oga una God go take una enter di land wey E give una grand-grand papa, so dat e go bi una own too. E go make una prosper and many pass una grand-grand papa dem.
6
Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.
7
But di Oga una God go put all dis curse for una enemies head and doz wey dey won kill una.
8
Den una go obey God vois kon keep all en kommand wey I dey kommand una today.
9
For all di work wey una go do with una hand, God go make una prosper. Una and una animals go get plenty pikin and una plant go produce plenty food. Bikos God go dey happy to make una prosper, just as E dey happy wen una grand-grand papa dey prosper.
10
Dis tin go happen wen una obey di Oga una God vois kon keep all en law and kommand wey dem rite for di Law Book, bikos una don turn kom meet God with all una heart and soul.
11
Di way wey I dey kommand una today, nor dey too strong for una and e nor too mush.
12
E nor dey for heaven so make nobody sey, “Who go-go heaven go bring di kommand kom for us, so dat wi go hear and do am?”
13
Di kommand nor dey for di oda side for di river, so una nor nid to ask, “Na who go cross di river go bring am for us, so dat wi go hear and obey am?”
14
But di word and kommand dey here with una. Una know am and una fit read am, so make una obey am.
15
Make una know sey, “I dey give una choice between good and bad; life and deat.
16
If una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today so, den una kon love di Oga una God; dey do as E tok; dey keep en rules, law and kommand, una go get long life kon dey many more-more and di Oga una God go bless una for di land wey una won enter as una own.
17
“But if una turn against God and E kommand kon dey woship juju and oda gods,
18
I dey tell una today sey una go die! Una nor go stay tey for di land wey una dey cross Jordan River go take as una own.
19
“I koll heaven and eart make dem bi witness against una today sey, I don give una choice between life and deat, blessing and curse. So make una choose life, so dat una with una shidren go get long life.
20
Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”
← Chapter 29
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 31 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34