bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Exodus 1
Exodus 1
Nigerian Pidgin Bible
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 2 →
1
Dis na Jakob shidren wey follow am go Egypt and each one karry en family follow body:
2
Reuben, Simeon, Levi, Judah,
3
Issakar, Zebulun, Benjamin,
4
Dan, Naftali Gad and Asher.
5
Jakob family for Egypt, na seventy (Josef don already dey Egypt before dem kom).
6
Afta sometaim, Josef, en brodas and doz wey bi dia age mate kon die.
7
So Israel pipol kon plenty and dey strong for di land.
8
Den one new king wey nor know Josef kon dey rule Egypt.
9
So di king kon tell en pipol, “Make una si, Israel pipol dey plenty and dem strong pass us!
10
Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.”
11
So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put.
12
But even as Egypt pipol dey opress Israel pipol, dem still dey plenty more-more for di land and Egypt pipol kon dey fear dem well-well,
13
so dem kon dey ponish Israel pipol anyhow.
14
Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.
15
Di king wey dey rule Egypt kon tell Shifrah and Puah wey bi di Hibru nurse sey;
16
“Anytime wen una dey help di Hibru wimen wey won born, if una si sey di pikin na boy, make una kill-am, but if na girl, make una nor kill-am.”
17
But di nurse dem dey fear God and dem nor gri do wetin di king tell dem, so dem nor kill di boys.
18
Den di king koll di nurse kon ask, “Why una do dis kind tin? Why una nor kill di boys?”
19
Di nurse ansa Fero, “Hibru wimen nor bi like Egypt wimen; dem strong well-well and before wi go even rish der, dem don born!”
20
So God favor di nurse dem and Israel pipol kon dey plenty and strong.
21
Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.
22
So Fero kommand en pipol, “Make una go kill any boy wey dem just born kon trow dem inside River Nile, but make una leave all di girls.”
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 2 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40