bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Exodus 32
Exodus 32
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 33 →
1
Wen di pipol si sey Moses nor dey kom down from di mountin, dem gada round Aaron kon tell am, “Make yu make one god for us wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt!”
2
So Aaron tell dem, “Make una bring di golds wey dey una wifes, sons and dotas ear kom.”
3
So, di pipol take dia gold go give Aaron.
4
Aaron kollect and melt di gold kon mold melu for dem. Wen di pipol si di melu, dem kon sey, “Israel pipol, dis na di god wey lead us komot from Egypt.”
5
Aaron si as di pipol dey happy, so e build altar for di melu front kon sey, “Tumoro go bi Oga God Feast.”
6
Di pipol wake-up di next day to offa burnt and peace ofrin. Afta dis, dem celebrate kon dey chop and drink, den dem start to do wetin God sey make dem nor do.
7
God kon tell Moses, “Make yu kwik-kwik go down! Yor pipol wey yu take komot from Egypt don dey sin and rijet mi.
8
Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”
9
Den God sey, “I don si how dis pipol sturbon and nor dey hear word.
10
Naw, make yu leave mi, so dat as I dey vex, I go distroy all of dem and I go make anoda great nashon from yu.”
11
But Moses beg God kon sey, “My Oga! Why Yu dey vex with yor pipol wey Yu take komot from Egypt with great pawa and mighty hand?
12
Why Yu won let Egypt pipol sey, ‘Dia God save dem with di mind to kill all of dem for di mountin kon distroy dem komot from di eart?’ Make Yu shange yor mind about wetin Yu won do yor pipol, so dat Yu nor go dey vex for dem.
13
Make Yu remember Abraham, Isaak and Israel yor savants wey Yu promise sey, ‘I go make una shidren-shidren plenty like di stars for sky and all dis land wey I don tok about, I go give dem to una shidren-shidren and dem go stay der forever.’ ”
14
God shange en mind, so E nor kon ponish en pipol again.
15
Moses kom down from di mountin with di two kommandment stones for en hand. God rite for di two side for di stones.
16
Naw di stones dem na God word and na God rite wetin dey inside di two stones.
17
Wen Joshua hear di nois as di pipol dey shaut, e kon tell Moses sey, “Na war sound wi dey hear so for di kamp o-o.”
18
But Moses ansa, “Dat sound nor bi pipol wey dey shaut, bikos of viktory or kry bikos of defeat, but na music sound I dey hear.”
19
Wen Moses waka near di kamp kon si di melu and di way di pipol dey dance, e vex well-well. E trowey di stones wey dey en hand and dem kon break to pieces.
20
E take di melu wey dem make, burn am inside fire; grind am to powder kon pour am inside wota and e force Israel pipol make dem drink am.
21
Moses kon tell Aaron, “Wetin dis pipol do yu wey make yu kause dis great sin for dem?”
22
Aaron ansa, “My oga, make yu nor vex too mush for mi; yu know sey dis pipol wiked.
23
Dem tell mi sey, ‘Make yu make god wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt.’
24
So I tell dem, ‘Anybody wey get gold make e bring am kom.’ Wen dem give mi, I melt am and di gold kon turn to dis melu.”
25
Moses si sey bikos of Aaron, di pipol nor fit kontrol diasef again and dia enemies dey laf dem.
26
So Moses stand for di kamp gate kon shaut sey, “If yu dey God side, make yu kom meet mi.” Den Levi tribe gada go meet am.
27
Moses tell dem, “Di Oga wey bi Israel pipol God sey, ‘Make evribody karry dia swod, bigin kill each oda thru-out di kamp. Make una bigin kill unasef, brodas, friends and neighbours.’ ”
28
So Levi pipol kon do wetin Moses kommand and dat day, na about 3,000 pipol die.
29
Den Moses tell Levi pipol, “Today, una don prepare unasef as priest to serve God, bikos una obey am even doh una nid to kill una sons and brodas. So God don bless una.”
30
Di next day, Moses tell di pipol, “Una don kommit sirious sin; but naw, I go-go meet God, may bi E go fit forgive una.”
31
So Moses go meet God kon sey, “True-true, dis pipol don kommit sirious sin as dem make gold juju for demsef.
32
God, make Yu forgive dem, but if Yu nor go forgive dem, den make Yu remove my name from di book wey Yu rite.”
33
God ansa Moses, “No, doz wey sin against mi, na only dia names I go remove from my book wey get life.
34
Naw make yu dey go; karry di pipol go di place wey I bin tell yu! Si, my angel go lead yu. Wen di day rish wen I go judge each pesin akordin to wetin e do, den I go ponish evribody for dia sin.”
35
So, God send diziz go meet di pipol, bikos dem woship di melu wey Aaron make.
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 33 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40