bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Exodus 13
Exodus 13
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 14 →
1
God kon tell Moses:
2
“Make yu dedikate all di first-born wey bi man for Israel give mi, weda na human being or animals.”
3
So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.
4
Una komot from Egypt for Abib mont.
5
Afta God don take una enter Kanaan, Hit, Amor, Hiv and Jebus pipol land; di place wey E promise una grand-grand papa sey E go give dem, land wey good well-well, den una go dey celebrate dis feast for di first mont for evry year.
6
For seven days, make una chop bread wey nor get yist and for di sevent day, una go do feast for di Oga una God.
7
Una go chop bread wey nor get yist for seven days and make una nor keep any bread wey get yist for una house.
8
“Make una tell una shidren for dat day sey, ‘All dis tins wey wi dey do so, na bikos of wetin awa God do for us wen wi komot from Egypt.’
9
Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.
10
Una must celebrate dis feast for di rite time for di year.
11
“Wen di Oga una God don take una enter Kanaan pipol land as E promise una and una grand-grand papa,
12
una must give all di first-born wey bi man, both human being and animals to Oga God.
13
Una fit take donkey first-born from God if una gi-am one lamb or yong goat. But if una nor kollect am back, una must break en neck. But una must buy una first son back.
14
“Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.
15
Wen Fero nor gri free us, di Oga awa God kon kill all di first sons for Egypt, both human being and animal. Dis na di rizin why wi dey sakrifice all di first-born son give God, but wi dey buy dem back.’
16
Dis matter go bi like sign for una hand and fore head, so dat una go remember as di Oga God take karry us komot from Egypt with en mighty pawa.”
17
Wen Fero free di pipol, God nor take dem pass Filistia pipol land even doh, na dat side near pass, bikos God sey, “Make di pipol nor go shange dia mind wen dem si war kon sey, ‘Wi won go back to Egypt.’ ”
18
So God lead di pipol pass di wildaness wey face di Red Sea. And Israel pipol prepare demsef for war as dem dey komot from Egypt.
19
Moses pak Josef bones, bikos Josef don make Israel pipol swear wen e sey, “God go kom save una and una must karry my bones komot from dis place.”
20
So dem travel from Sukkot go Etam for di wildaness korna.
21
Naw, God dey lead dem with kloud for day time, den for nite, E dey lead dem with fire, so dat dem go fit travel both for day and nite.
22
Oga God nor remove di kloud for day time or di fire for nite.
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 14 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
Recommended Reading
Commentary
Exodus Commentaries
→
Devotional
Exodus Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→