bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Exodus 19
Exodus 19
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 18
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 20 →
1
Israel pipol rish Sinai Wildaness for di first day for di third mont afta dem komot from Egypt.
2
Afta dem travel komot from Refidim, dem rish Sinai Wildaness kon stay for di mountin front.
3
God koll Moses from di mountin kon tell am, “Dis na wetin yu go tell Jakob house and Israel pipol:
4
‘Una don si wetin I do Egypt pipol. Una si as I take karry una for eagle feada kon bring una kom meet mi.
5
And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.
6
Una go bi my kingdom priests and holy nashon wey dem dedikate give mi.’ Dis na wetin yu go tell Israel pipol.”
7
So Moses koll all di eldas for Israel kon tell dem wetin Oga God kommand am.
8
All di pipol ansa, “Wi go do evritin wey di Oga awa God don kommand us.” So Moses go back go meet God kon tell am wetin di pipol tok.
9
Den God tell Moses, “I go kom meet yu inside tick kloud, so dat di pipol go hear wen I dey tok to yu and dem go always bilive yu.” Moses tell God wetin di pipol tok.
10
God tell Moses, “Make yu use today and tumoro take santify di pipol kon tell dem make dem wosh dia klot
11
and ready for di third day, bikos for dat third day, I go kom from Mount Sinai and all di pipol go si mi.
12
Tell evribody where dem go waka rish kon sey, ‘Make anybody nor klimb di mountin or tosh en korna. Anybody wey tosh di mountin, go die!
13
Nobody go tosh di pesin, but dem go stone am or shot am with arrow. E must die, weda na human being or animal.’ Wen dem blow di ram horn, di pipol go-go di mountin front.”
14
Den Moses kom down from di mountin go meet di pipol. E santify and make dem wosh dia klot.
15
E tell dem, “Make una dey ready for di third day and make di men nor sleep with dia wifes.”
16
For morning for di third day, tonda, lite and one tick kloud kon appear on-top di mountin, so dem blow di horn well-well. Fear katch all di pipol for di kamp.
17
Moses take di pipol komot from di kamp go meet God and dem stand for di mountin front.
18
Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.
19
Wen dem blow di horn well-well, Moses start to tok and God kon dey ansa am.
20
God kom on-top di mountin kon sey make Moses kom meet am for der, so Moses kon go up.
21
God tell Moses, “Make yu go down go warn di pipol sey make dem nor waka pass where yu tell dem, bikos dem won si wetin dey happen and anybody wey nor listin to yu, go die.
22
Even di priests wey dey near mi, make yu tell dem make dem wosh demsef well-well, if not I go distroy dem too.”
23
Moses kon tell God, “Di pipol nor go fit kom Mount Sinai, bikos Yu really warn us sey, ‘Di mountin na where dey holy, so make una nor waka near am.’ ”
24
But God tell Moses, “Make yu go down, den kom back again with Aaron, but nor let any priests or di pipol waka pass or near di mountin, bikos I go ponish dem.”
25
So Moses go down go meet di pipol kon tell dem wetin God tok.
← Chapter 18
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 20 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
Recommended Reading
Commentary
Exodus Commentaries
→
Devotional
Exodus Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→