bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Proverbs 16
Proverbs 16
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 15
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 17 →
1
Even doh wi fit make awa own plans, na God get di final sey.
2
Yu fit tink sey yu dey always do di rite tin, but na God know wetin dey rite to do.
3
If yu tell God make E bless evritin wey yu plan to do, yu go susid.
4
Evritin wey God kreate get en purpose; but na wahala, wiked pipol go get.
5
God hate pipol wey dey karry body up; E nor go let dem eskape en ponishment.
6
If pesin dey honbol and faithful, God go forgi-am en sins. If yu dey fear God, yu nor go gri do bad tins.
7
Wen pesin make belle sweet God, even en enemies go like bi en friend.
8
E betta to dey honest even doh yu nor get plenty money, dan to use wayo get plenty propaty.
9
Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.
10
Di king dey tok with authority wey God gi-am, so make e make sure sey e dey judge well.
11
Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol, bikos God nor like am.
12
Make kings nor like wiked tins, bikos na korrect judgement dey make govment strong.
13
Kings dey always won hear di trut and e go favor doz wey dey tok am.
14
Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.
15
Wen di king favor pesin, e dey give life; e bi like kloud wey dey bring rain for en sizin.
16
E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
17
Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.
18
Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.
19
E betta make yu dey honbol and poor, dan to join pipol wey dey karry body up kon follow dem share di propaty wey dem tif.
20
Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful; make yu trust God, so dat blessing go follow yu.
21
Yu go no pesin wey wise and dey mature bikos of di undastandin wey e get. As en word sweet rish, na so too e dey give pipol hope.
22
Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.
23
Wise pesin dey tink well before e dey tok; so wetin e tok dey give pipol hope.
24
Good words bi like honey; e dey sweet di soul kon make body strong.
25
Wetin pesin dey do, fit dey good for en eye, but na deat dey end am.
26
Pesin wey wont sometin dey work well for am, bikos e nid am.
27
Wiked pipol dey always look for how to wound odas; even wetin dem dey tok fit burn and kill pesin like fire.
28
Wiked pipol dey do aproko waka; dem dey kause trobol and break friendship.
29
Pipol wey dey kause wahala dey deceive dia friends enter trobol.
30
Make yu dey kareful with doz wey dey look yu with bad eye, bikos dem don already dey tink bad tin about yu.
31
Na long life bi raitious pipol reward and to get white hair, na betta crown.
32
E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.
33
Wi dey plan as wi wont make tins bi, but na only God dey choose wetin go happen.
← Chapter 15
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 17 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31