bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Proverbs 6
Proverbs 6
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 5
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 7 →
1
My pikin, if yu gri sey yu go pay di debt wey yor friend owe
2
and dem kon owe yu for di promise wey yu make,
3
make yu follow dis my advise, so dat yu go free yorsef, bikos yu don fall enter yor neighbour hand bi dat. Just go honbol yorsef and beg yor neighbour, so dat e go free yu.
4
Make yu do as I tell yu before sleep go katch yu! Nor rest until yu do am.
5
Just try komot yorsef from di trap like bird wey komot from trap or like deer wey eskape from hunta.
6
Lazy pipol, make una learn lesin from di way ant dey live dia life.
7
Dem nor get leader, govnor or who dey rule dem,
8
but dem dey store dia food for dry sizin, dey wait for wen rainin sizin go start.
9
But na how long lazy man go take dey liedan for en bed? Wen e go ever get up?
10
E go sey, “Make I just sleep; fold my hand and rest small.”
11
But as e dey sleep, evritin wey e get go vanish like sey na tif karry dem go.
12
Wetin yuzles and wiked pipol bi like? Na lie dem just dey lie waka.
13
Dem go use dia eyes take make sign kon use dia legs and fingers take deceive pipol.
14
Na bad plans full dia heart and na so-so trobol dem dey kause.
15
Bikos of dis, dem nor go know before wahala go kom meet and distroy dem finish.
16
E get seven tins wey God hate and E nor wont make anybody do dem and dem bi:
17
“Proud pipol; doz wey dey lie; doz wey dey kill innocent pipol;
18
pipol wey dey always tink bad tins; pipol wey dey rush to go do wiked tins;
19
doz wey dey lie for anoda pesin head and pipol wey dey kause trobol among dia friends.”
20
My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu and nor ever forget wetin yor mama tish yu.
21
Always keep and lock dia words for yor heart! Tie dem round yor neck too.
22
Wetin dem tish yu so, go lead yu wen yu dey waka, protet yu for nite kon give yu good advise for day time.
23
Wetin dem sey make yu do, bi like lite and dia korreshon go fit tish yu how to live yor life.
24
E go keep yu from bad wimen and from di sweet-sweet words wey oda men wife dey tok.
25
Nor let dia beauti tempt yu and nor let dia wayo eyes make yu fall.
26
Bikos to sleep with ashawo fit make man poor, but to sleep with anoda man wife go make yu luz yor life.
27
Yu fit put fire for yor chest make e nor burn yu?
28
Abi yu fit waka on-top hot shako make e nor burn yor leg?
29
Na so e go bi too, if yu sleep with anoda man wife and anybody wey do dat kind tin, go sofa.
30
Pipol fit sorry for pesin wen e tif bikos e dey hongry
31
but if dem katch am, e must pay back wetin e tif seven times, even if e nid to sell evritin wey e get.
32
But man wey dey sleep with anoda pesin wife, nor get sense at-all and e just dey distroy ensef by ensef.
33
Pipol go hate, beat and disgrace am and shame go follow am forever.
34
Bikos jealousy dey make husband vex well-well and e nor dey show mesi wen e won revensh.
35
E nor go gri take any money and no amount of gift go stop en vexnashon.
← Chapter 5
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 7 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31