bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Proverbs 26
Proverbs 26
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 25
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 27 →
1
Just as pipol nor dey espect rain for dry sizin, na so too, respet nor good for foolish pesin.
2
Just as bird dey fly pass, na so too, curse wey dem put for yor head and yu nor deserve am, nor go do yu anytin.
3
E dey eazy to whip horse and kontrol donkey, but e nor eazy to kontrol foolish pesin.
4
If yu ansa yeye kweshon wey foolish pesin ask, den yu dey foolish, just like di pesin wey ask yu.
5
Make yu ansa fool akordin to en kweshon, so dat e go know sey e nor wise as e tink, but if yu nor ansa am, yusef go bi fool like am.
6
Just as if pesin kut en own leg komot, na so e bi too to send fool message, bikos na trobol di pesin dey look for.
7
As pesin wey en leg cripple nor fit use am, na so too foolish pipol words dey yuzles.
8
To praiz foolish pesin bi like to put stone for katapault kon ready to shot am.
9
Like shuku-shuku wey shuk drunkard man hand, na so too wise word bi for foolish pesin mout.
10
Like pesin wey dey shot en arrow anyhow, na so too e bi to pesin wey hire fool take work.
11
Just as dog dey go back go chop en vomit, na so fool dey always show en foolishness.
12
Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense.
13
Lazy pesin go sey, “Lion dey for outside! Many lion dey evriwhere for di street!”
14
Lazy pesin go just dey turn up-and-down for bed like door handle and
15
some pipol too lazy to even put food for dia own mout.
16
Lazy pesin go tink sey en wise pass seven pipol wey get sense well-well.
17
Pesin wey go argue matter wey nor koncern am, bi like wen yu dey waka for road kon go hold dog for en ear.
18
Just as e bad for mad pesin to play with bow and arrow,
19
na so too e bi with pesin wey deceive en neighbour and e sey, “Nor bi joke I dey joke?”
20
Fire nor dey katch without wood; so without aproko, kworel nor go dey.
21
Pipol wey like wahala dey kause trobol, just as mashes and kerosine dey start fire.
22
Aproko story dey sweet some pipol well-well, but to odas, e dey pain well-well go rish dia bones.
23
Pesin wey get wiked heart and dey lie well-well, bi like fine klot wey dem take kover klay pot, so dat pipol go tink sey na betta tin dey der.
24
Pesin wey hate odas and dey pritend sey e like dem, na wikedness full en heart.
25
Even doh e tok sweet words, make yu nor bilive am, bikos na wikedness full en belle.
26
E fit hide en wikedness, but evribody go soon si di bad tins wey e dey do.
27
So, anybody wey dig pit for pesin go fall inside my ensef and pesin wey roll stone to wound odas, na di stone go fall kill-am.
28
Na only pesin wey yu hate, yu go like lie against and yeye words dey distroy pipol.
← Chapter 25
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 27 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31