bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Proverbs 9
Proverbs 9
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 8
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 10 →
1
Wisdom don build en house with seven pilas.
2
E don kill animals to take do party, mix spice for inside di wine kon put am for di tabol.
3
E send en savant go announce on-top di mountin for di town sey:
4
“Pipol wey nor know anytin, make una kom inside!” Den e tell doz wey foolish sey,
5
“Make una kom chop my food and drink di wine wey I mix.
6
Make una komot from where fools dey and una go get life. Make una kom follow wisdom waka.”
7
If yu korrect proud pipol, dem go curse yu! Anybody wey try to tok to wiked pipol, dem go still curse am.
8
So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever.
9
Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.
10
If yu won get wisdom, yu go first fear God. If yu know di One wey dey holy, den yu don get undastandin.
11
Wisdom go add more years to yor age.
12
Na yu go gain if yu get wisdom, so even if yu rijet am, na yu go still sofa am.
13
Foolishness bi like woman wey nor know anytin at-all, nor get shame at-all and wey dey tok anyhow.
14
Di woman go sidan for front of en house or for chair for di side wey high pass for di town
15
kon dey koll pipol wey dey waka pass; pipol wey dey mind dia own business sey,
16
“Pipol wey nor get sense, make una kom inside!” Den e go tell foolish pipol,
17
“Wota wey dem tif dey sweet well-well and bread wey dem tif chop, get betta taste.”
18
Doz wey fall for en trap nor know sey, anybody wey enter en house go die and doz wey don already enter don die since.
← Chapter 8
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 10 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31