bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Revelation 10
Revelation 10
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 11 →
1
Den I si anoda angel wey get pawa dey kom down from heaven inside kloud and rainbow dey on-top en head. En face dey shine like sun and en leg bi like big fire.
2
E hold one small book wey open for en hand and e stand with en rite leg on-top sea kon put en left leg for land.
3
Den e shaut with loud vois like lion and seven tundas ansa am.
4
I dey ready to rite wen di seven tundas dey tok, but I hear one vois from heaven dey sey, “Anytin wey di seven tundas tok, make yu keep am as sekret and nor rite dem at-all.”
5
Den di angel wey stand for di sea and land, raiz en rite hand go heaven.
6
E swear with di Pesin name wey go dey forever and ever. Na dis Pesin kreate di heaven, eart, sea and evritin wey dey inside dem, den di angel kon sey, “Time go soon rish!”
7
Wen di sevent angel go blow en trumpet, God sekret plan wey nobody undastand, go kom out. E go happen just as E tell di profets, wey bi en savants.
8
Den di vois from heaven tell mi again, “Di angel wey stand for wota and land, make yu go take di book wey dey en hand.”
9
So I go meet di angel sey make e give mi di book, but e sey, “Take am make yu chop am.” E still sey, “As yu dey chop am, e go sweet like honey for yor mout, but wen yu swallow am, e go make yor belle bitter.”
10
So, I take di book from di angel hand kon chop am. True-true wen I dey chop am, e sweet like honey for my mout, but wen I swallow am, e kon bitter for my belle.
11
Den di angel tell mi, “Yu go still profesai about many pipol, kountry, language and kings.”
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 11 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22