bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Revelation 15
Revelation 15
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 16 →
1
Den I si anoda big sign for heaven wey nobody go fit undastand: seven angels whole di seven last wahala and na dis ones go komplete God vexnashon.
2
I kon si anoda tin wey bi like river wey dem mix with fire and I still si di pipol wey konker di beast, en image and di nomba for en name. Dem stand near di river kon whole harp wey God give dem.
3
Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.
4
Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”
5
Afta all dis, I kon si di temple for heaven open and di kovenant tent dey inside.
6
Den di seven angels wey whole di seven last wahala kon kom out from di temple and dem wear klean klot wey dey shine well-well, kon tie gold belt for dia chest.
7
Den one among di for creatures kon give di seven angels seven gold basin wey full with God wey go live forever and ever, vexnashon.
8
Den, smoke kon full di temple with God glory and pawa. And nobody fit enter until di seven wahala wey di angels bring, don komplete.
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 16 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22