bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Revelation 17
Revelation 17
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 18 →
1
Den one from di seven angel wey whole di seven basin tell mi, “Kom make I go show yu how God go kondemn and ponish dat ashawo wey sidan on-top plenty wota.
2
Di kings for eart dey sleep with am and en sin don shark dis world pipol like wine.”
3
So for di vishon, di angel karry mi go wildaness and for der, I kon si one woman sidan on-top one red beast and wetin dem rite for en body, na to curse God. Di beast get seven heads and ten horns.
4
Di woman wear purpol and red klot kon wear gold for neck. E wear stones and beads wey dear. E hold one gold cup for hand and na yeye tins with sins full inside.
5
Dem rite one sekret name for en fore head wey bi: “Babilon wey big well-well, ashawo pipol and yeye tins mama.”
6
God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.
7
But di angel tell mi, “Why yu dey sopraiz like dis? I go tell yu di sekret plan wey di woman and di beast wey karry am, get. Dis na di beast wey get seven heads and ten horns.
8
Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.
9
(Na only pipol wey get wisdom go undastand dis tin.) Di seven head na seven mountin wey di woman sidan put and dem still bi seven kings.
10
Five don fall, one dey rule naw and one go still kom, but e nor go rule tey.
11
Di beast wey dey before and nor dey again, en ensef na di nomba eight beast, but na still one for di seven and dem go distroy am.
12
Di ten horns wey yu si, na ten kings wey neva get kingdom yet, but dem go give dem authority to follow di beast rule as kings for one hour.
13
Di kings get di same mind and na di same tins wont. And dem go give di beast dia pawa and authority.
14
Dem go follow di Lamb fight war, but di Lamb go win dem, bikos na en bi Oga God for all ogas, King for all kings and pipol wey dey follow di Lamb, na doz wey e koll, choose and save.”
15
Den di angel kon tell mi, “Di wota wey yu si, wey di ashawo sidan on-top, na many pipol, tribe, kountry and language.
16
Di ten horns wey yu si and di beast, go hate di ashawo kon kollect all wetin e get, den e go dey naked. Dem go chop en body kon burn am with fire.
17
Bikos God don put am for dia mind sey dem go do wetin E wont and dem go use one mind take give dia pawas to di beast, until God word go komplete.
18
And di woman wey yu si, na Babilon, di big town wey get pawa to rule all di kings for di world.”
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 18 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22