bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Revelation 13
Revelation 13
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 14 →
1
Den I si one beast dey kom out from di sea. E get ten horns, seven head and ten crowns dey en horns. For en head, name wey dey curse God, naim dem rite put.
2
Di beast wey I si, bi like leopard, but en leg bi like bear leg and en mout bi like lion own. Di dragon kon gi-am pawa, en throne and strong authority to rule.
3
One for di beast head bi like wetin dem wound well-well, but di wound don go. Di whole world dey sopraiz kon dey follow di beast.
4
Dem dey woship di dragon, bikos na-im give di beast pawa to take rule. Dem dey woship di beast sey, “Who bi like di beast? Na who fit follow am fight?”
5
Dem give di beast mout wey dey tok bad-bad words. Di beast dey curse God and e rule for forty-two monts.
6
So di beast open en mout dey curse God, en name, where E dey stay and doz wey dey heaven.
7
Satan gi-am pawa to fight with God pipol and to win dem. E still gi-am authority to rule evry tribe, group, language and kountries.
8
Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.
9
If anybody get ear, make e hear!
10
Anybody wey dem suppose to katch, dem go katch am. Anybody wey swod go kill, dem go kill-am with swod. So, God pipol must bear well-well and get faith.
11
Den I si anoda beast dey kom out from groun. E get two horns like small sheep own, but e dey tok like dragon.
12
E kollect all di pawa wey dey make di eart and evribody woship di first beast (wey en big wound don go).
13
E dey do big mirakles and e even dey send fire kom down from heaven for di pipol front.
14
E deceive di pipol for dis eart with di mirakles wey e dey do for di beast front and e tell di pipol sey, make dem make one image for di beast (wey wound before, but still dey alive).
15
Di sekond beast still get pawa to give life to di first beast image, so dat e go fit tok and kill doz wey nor gri woship di first beast image.
16
E still sey, make evribody, weda small or big, rish or poor, free pesin or slave, kollect di beast mark for dia rite hand or fore head
17
and make nobody buy or sell anytin, unless e get di beast mark, nomba or name for en body.
18
Dis one nid wisdom; make di pesin wey fit undastand kount di beast nomba: bikos na human being nomba e bi and di nomba na six hundred and sixty six.
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 14 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22