bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Numbers 15
Numbers 15
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 16 →
1
God tell Moses,
2
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen una enter di land wey I go give una,
3
make una give mi one melu, one ram, one sheep or goat as burnt ofrin. Nor bi sakrifice to pay una vow or free will or first ofrin; put na ofrin wey God like en smell,
4
den di one wey dey give en ofrin to God must go bring each animal with one kilogram of flower wey dem mix with one lita of olive oil for korn ofrin,
5
togeda with one lita of wine for drink ofrin.
6
“ ‘If na ram e one give, two kwota for flower wey dem mix with one and half lita of olive oil and na dem e go give as korn ofrin,
7
with one and half lita of wine, as drink ofrin. God like dis sakrifice smell well-well.
8
“ ‘If na melu dem give God as burnt ofrin or as sakrifice to take pay dia vow or fellowship ofrin,
9
dem go bring korn ofrin of six kwota for flower wey dem mix with two lita of olive oil, den
10
two lita of wine, as drink ofrin. God like dis sakrifice smell well-well.
11
Na so too una go prepare each sakrifice wey bi melu, ram, sheep or goat.
12
If dem give more dan one ofrin, di ofrin wey go follow am go inkrease.
13
“ ‘All di pipol wey dem born for Israel go do like dis anytime wey dem won give ofrin, bikos God like di ofrin smell well-well.
14
And if strenja dey stay among una, weda na for sometaim or forever and dem won offa ofrin wey get sweet smell to God, dem must follow di rules and regulashon.
15
Na di same law una and strenjas wey dey with una go obey forever, bikos all of una na di same for God eye;
16
di same law and rules naim all of una go obey forever.’ ”
17
God tell Moses:
18
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen una enter di land wey I dey take una go
19
and una chop some of di food wey dey di land, una must keep some as special ofrin to God.
20
Una go give kake from una first flower wey una grind as special ofrin, just as una do for di first korn wey una grind.
21
Una and una shidren-shidren must give God some for di first flower wey una grind as special ofrin forever.
22
“ ‘If una nor know kon kommit sin and break di kommand wey God give una thru Moses,
23
all wetin God kommand una thru Moses, from di day wey God kommand Moses go rish una shidren-shidren,
24
den if una do anytin wey nor kom from una mind and di kommunity nor know about am, di kommunity must give one yong melu as burnt ofrin to take klean demsef.
25
Den di priest go do di sakrifice for di kommunity and I go forgive dem, bikos dem nor sin from dia mind and dem don bring dia ofrin; ofrin wey dem make with God fire and ofrin to klean demsef for God present, bikos of di sin wey dem nor kommit from dia mind.
26
I go forgive all di kommunity and di strenjas wey dey stay with dem, bikos na all of dem kommit di sin wey nor kom from dia mind.
27
“ ‘If anybody kommit di sin wey nor kom from en mind, den e must give one goat wey bi one year to take klean ensef.
28
Di priest must do di sakrifice for di pesin wey kommit di sin, den I go forgi-am.
29
Una must get one law for di pesin wey nor kommit sin from en mind, both for Israel pipol and di strenjas wey dey stay with una.
30
“ ‘But anybody wey kommit sin with en mind, weda dem born am for Israel or na strenja, dat pesin don curse God and dem must kill-am,
31
bikos e nor gri do wetin God tok or obey en kommand. Na en use en hand kill ensef.’ ”
32
Wen Israel pipol still dey for wildaness, dem si one man dey pak wood for Sabat Day.
33
Di pipol wey si am kon take am go meet Moses, Aaron and di kommunity.
34
Dem put di man for prison make sojas guide am, bikos dem nor know wetin dem go do am.
35
Den God tell Moses, “Di man must die; make di whole kommunity take am go outside di kamp kon stone am till e die.”
36
So di whole kommunity take am go outside di kamp kon stone am till e die, just as God kommand Moses.
37
God tell Moses:
38
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Make dem tie tread for dia klot forever kon use blue tread dekorate di korna.
39
Una must get dis tread, so dat wen una look am, una go remember all God kommand kon do dem and una nor go allow una heart or eye turn una from mi.
40
Like dat, una go remember and obey my kommand kon dey holy to una God.
41
Na mi bi di Oga una God; wey take una komot from Egypt, so dat I go bi una God. Na mi bi God.’ ”
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 16 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36