bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Numbers 23
Numbers 23
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 24 →
1
Balaam kon tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi, den bring seven melu and seven ram.”
2
So Balak do wetin Balaam tok. Balak and Balaam kon give one melu and one ram as ofrin for each altar.
3
Balaam tell Balak, “Make yu stand for here near yor burnt ofrin and I go-go pray and anytin wey God show mi, I go tell yu.” So only Balaam kon go on-top di hill.
4
God kom meet Balaam and Balaam sey, “I don build di seven altar and I don give one melu and one ram for each one.”
5
Den God tell Balaam, “Go back go meet Balak, tell am wetin I tell yu.”
6
So Balaam go meet Balak for where en stand (near en burnt ofrin), both en and all di prince dem for Moab.
7
Den Balaam profesai kon sey: “King Balak for Moab bring mi kom from Aram, from di mountin wey dey di east kon sey, ‘Make yu kom help mi curse Israel pipol.’
8
Na how I wont take curse pipol wey God nor curse? Or how I go take distroy wen God nor send mi?
9
I dey si dem from where I stand on-top di rock; I dey look dem from di hill. Dem bi one nashon wey dey stay alone; dem know sey dem dey bless pass oda nashon.
10
Who go fit kount Jakob dust, dem too many to kount. Make I die as God pikin; make I die in peace as betta man.”
11
Den Balak tell Balaam, “Wetin yu do mi so? I sey make yu help mi curse my enemy, but yu kon dey bless dem!”
12
Balaam ansa, “Na only wetin God tell mi, I go fit tok.”
13
Balak kon tell am, “Abeg, follow mi go anoda place where yu go si some Israel pipol, den help mi curse dem from der.”
14
So Balak take Balaam go Zofim field, on-top Pisgah, where e for build seven altar kon give one melu and one ram for each of dem.
15
Balaam kon tell am, “Make yu stand near yor burnt ofrin and I go-go pray to God.”
16
God kom meet and tell Balaam, “Make yu go back go meet Balak kon tell am wetin I tell yu.”
17
Wen Balaam kom back, e si sey Balak still stand near di burnt ofrin, with di prince dem for Moab. So Balak ask, “Na wetin God tok?”
18
Balaam kon profesai, “Make una kom! Balak wey Zippor born, make yu kom hear wetin I dey tok.
19
God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.
20
E don kommand mi make I bless dem and wen God bless pesin, I nor go fit shange am.
21
Wahala nor go happen to Jakob shidren; Israel pipol nor go si trobol. Bikos di Oga wey bi dia God dey with dem and na-im bi di king.
22
Na God take dem komot from Egypt; E dey fight for dem like wiked melu.
23
Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’
24
Israel pipol go bi like strong lion wey nor dey rest until e don distroy en enemies kon drink di blood of di pesin wey e kill.”
25
Den Balak tell Balaam, “As yu nor gri curse Israel pipol, den make yu nor bless dem!”
26
But Balaam ansa, “I nor tell yu sey na wetin God tell mi, na-im I go do?”
27
Balak tell Balaam, “Abeg make yu kom; I go take yu go anoda place. May bi God go allow yu curse dem from der.”
28
So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness.
29
Den Balaam tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi kon bring seven melu and seven ram.”
30
So Balak do wetin Balaam tell am kon give one melu and one ram for each altar.
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 24 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36