bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Numbers 34
Numbers 34
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 33
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 35 →
1
Den God tell Moses:
2
“Make yu tell Israel pipol sey: ‘Wen una enter Kanaan land and evriwhere wey I promise to go give una;
3
den di borda for sout go start from Zin Wildaness go rish di borda for Edom. Una sout borda go face east go rish di Salt Sea.
4
Den e go turn from sout go Akrabbim kon kontinue go Zin till e rish Kadesh Barnea. E go-go nort-west to Hazar Addar and Azmon,
5
where e go for turn face di valley wey dey Egypt borda and Mediterranean Sea.
6
“ ‘Di borda for west go bi di Mediterranean Sea.
7
“ ‘Dis go bi una borda for nort: Una go draw line from Mediterranean Sea go Mount Hor
8
and from der, una go draw anoda line go Lebo-Hamat. E go kontinue from der go Zedad.
9
Di borda go kontinue rish Zifron kon end for Hazar-Enan. Dis go bi una nort borda.
10
“ ‘For di borda for east: Una go draw line from Hazar-Enan go Shefam.
11
Di borda go from Shefam go Riblah for di east side for Ain and for Chinneret Sea.
12
Den e go-go Jordan River go rish di Salt Sea.’ Dis go bi di four borda for una land.”
13
So Moses tell Israel pipol, “Dis na di land wey una go get thru dice wey dem trow. God don give di land to di nine and half tribes.
14
Bikos Reuben, Gad and half for Manasseh tribe wey kom from east, don get dia propaty
15
for di east side for Jordan River near Jeriko.”
16
God tell Moses,
17
“Eleazar di priest and Joshua wey Nun born go divide di land for di pipol.
18
So make yu take one leader from each tribe, so dat dem go help divide am too.
19
Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born;
20
from Simeon tribe, e pick Shemuel wey Ammihud born;
21
from Benjamin tribe, e pick Elidad wey Kislon born;
22
from Dan tribe, e pick Bukki wey Jogli born;
23
from Josef tribe, e pick Hanniel wey Efod born and na leader for Manasseh tribe;
24
from Efraim tribe, e pick Kemuel wey Shiftan born;
25
from Zebulun tribe, e pick Elizafan wey Parnak born;
26
from Issakar tribe, e pick Paltiel wey Azzan born;
27
from Asher tribe, e pick Ahihud wey Shelomi born;
28
from Naftali tribe, e pick Pedahel wey Ammihud born.”
29
Dis na di ones wey God kommand to divide di propaty among Israel pipol wey dey Kanaan land.
← Chapter 33
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 35 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36