bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Numbers 28
Numbers 28
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 29 →
1
God tell Moses:
2
“Make yu kommand Israel pipol sey: ‘Make una give God di rite food ofrin wey go make belle sweet am.
3
Dis na di food ofrin wey una go give to God evriday: two man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
4
Make una give di first lamb for morning and di sekond one for evening,
5
each one with di korn ofrin wey bi one kilogram for flower, wey dem mix with one lita of di best olive oil.
6
Dis na di evriday burnt ofrin wey dem go first give for Mount Sinai as dia food ofrin, bikos na betta ofrin e bi to God.
7
For di wine ofrin with di first lamb, make una pour one lita for di altar.
8
For evening, make una give di sekond lamb as una take give di first ofrin togeda with en wine ofrin. Na food ofrin e still bi and God like di smell well-well.
9
“ ‘For di Sabat Day, una must give two man lamb wey bi one year and dem must dey okay; two kilogram for flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and di wine ofrin.
10
Dis burnt ofrin go bi for evry Sabat Day plus di ofrin wey dem dey give evriday with en wine ofrin.
11
“ ‘Make una give di burnt ofrin to God as each mont start: two yong melu; one ram; seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay.
12
Una go add all dis tins join di korn ofrin wey dem mix; six kwota of flower with each melu, four kwota with each ram and
13
two kwota with each lamb. Dis burnt ofrin go bi special gift and God dey like di smell.
14
Una go still give di wine ofrin with each sakrifice: two kwota of wine for each melu, three kwota for di ram and one kwota for each lamb. Make una dey do dis sakrifice for di first day for evry mont
15
Una go still dey offa di evriday burnt ofrin with en wine ofrin and one man goat as sin ofrin.
16
“ ‘For di fourteent day for di first mont, una go dey do di Passova Feast to tank God.
17
For di fifteent day for di mont, una go start one holy festival wey go end for di sevent day and for doz days, na only bread wey nor get yist una go dey chop.
18
For di first day, una go gada woship and una nor go do any work.
19
But una must offa food ofrin to God: two melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
20
Make una give di rite korn ofrin wey bi flower wey dem mix with olive oil: three kilogram with each melu, two kilogram with di ram
21
and one kilogram with each lamb.
22
Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy.
23
Make una give dis plus di normal morning burnt ofrin.
24
Like dis too, for seven days, make una give God food ofrin, di smell wey E dey like well-well. Make una give all dis ones, plus di evriday burnt and wine ofrin.
25
For di sevent day, make una gada woship and make una nor do any work.
26
“ ‘For di first day wen una dey do di harvest feast, wen una dey give di ofrin for new korn to God, una go gada woship and una nor go do any work.
27
Make una give burnt ofrin, di kind smell wey God like well-well, dat is: two yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
28
Make una give di rite korn ofrin for flower wey dem mix with olive oil: three kilogram with each melu, two kilogram with di ram
29
and one kilogram with each lamb.
30
Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy.
31
Una go offa dem with di wine ofrin plus di normal burnt and korn ofrin and dem must dey okay.
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 29 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36