bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Numbers 36
Numbers 36
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 35
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
1
Doz wey dey lead Ramot tribe, wey Makir born and Manasseh wey Josef born, en grand-shidren kon go meet Moses and di oda leaders
2
sey, “God don kommand una make una trow dice take share di land give Israel pipol. E still kommand una make una give Zelofehad awa broda propaty to en dotas.
3
But make una remember sey, if dem marry from anoda tribe, dia propaty go kon bi dat tribe own and di total propaty wey go kon bi awa own, go kon small.
4
And wen Israel pipol won do dia Jubili, all di propaty wey dem don sell before, dem go give dem to di original owner kon add di propaty join Zelofehad dotas and na di oda tribe go get am. So dia propaty nor go kon join awa tribe propaty.”
5
As God kommand, Moses kon tell Israel pipol sey, “Wetin Manasseh tribe tok, dey rite,
6
so God sey di dotas wey Zelofehad born fit marry anybody wey dem won, but na only from dia own tribe.
7
Like dis, Israel propaty go still dey for dia tribe.
8
Any woman wey dem share propaty rish from Israel tribe, must marry man wey kom from dat tribe. Like dis, all Israel pipol go get dia papa propaty.
9
No propaty go komot from one tribe go anoda tribe. But evry one for di tribe for Israel go get en own propaty.”
10
As God kommand Moses, na so Zelofehad dotas do.
11
Di dotas wey Zelofehad born na: Mahlah, Tirzah, Hoglah, Milka and Noah. All of dem marry dia papa broda shidren.
12
Dem kon marry from Manasseh wey Josef born tribe and dia propaty kon remain for dia papa tribe.
13
Dis na di rule and laws wey God give Israel pipol thru Moses for Moab land opposite Jordan River for Jeriko.
← Chapter 35
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36