bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Isaiah 2
Isaiah 2
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 1
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 3 →
1
Dis na di message about Judah and Jerusalem wey God give Isaya wey bi Amos pikin.
2
Time dey kom wen di mountin where di temple dey, go dey important pass evry oda mountin. Many nashons go-go der
3
and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.
4
E go judge and setol kworel among nashons. E go setol many pipol kase. Dem go turn dia swod to ordinary blade kon use dia spear dey work for vineyard. Den, no nashon go fight against anoda nashon and dem nor go train pipol to fight war again.
5
So, Jakob shidren-shidren, make wi waka with di lite wey God take dey guide us!”
6
My God, Yu don forget yor pipol wey bi Jakob shidren-shidren, bikos dem dey do majik for evriwhere for di land; dem dey go meet majik pipol just as Filistia pipol dey do and na strenjas bi dia friends naw.
7
Na silva and gold full di land and Israel pipol propaty nor dey finish. Horse plenty for dia land and dia shariot, too many to kount.
8
Juju still full dia land too and dem dey woship tins wey dem use dia hand take make.
9
Pipol dey bow dey woship dem, so my God, make Yu nor forgive dem at-all!
10
Dem go hide inside rock and dig hole for groun make dem for fit eskape from God vexnashon and en glory.
11
Di day dey kom wen God go honbol proud pipol kon disgrace sturbon pipol. Den na only God, pipol go dey praiz.
12
True-true, God wey dey lead di sojas for heaven don plan di day wey E go judge evritin, bikos E go disgrace di pipol wey feel sey dem get pawa and dey make mout.
13
E go distroy all di tall cedar trees for Lebanon, with di oak trees for Bashan
14
kon level di high mountins and hills,
15
with evry high towa and strong wall.
16
Yes! E go sink and distroy big and fine-fine ship.
17
For dat day, God go distroy doz wey dey karry body up kon disgrace sturbon pipol and na only en name pipol go dey praiz.
18
E go distroy all di juju dem finish.
19
Wen God won kom shake dis eart with en pawa and glory, pipol go hide for hole, inside rock den dig hole for groun so dat dem go eskape from God vexnashon.
20
Wen dat day go rish, pipol go karry di gold and silva juju wey dem make for demsef kon trow and abandon dem give rats and bats.
21
True-true, wen God go kom shake di world, pipol go hide inside hole for rock, so dat dem go fit eskape from God vexnashon and en glory.
22
So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?
← Chapter 1
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 3 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52
53
54
55
56
57
58
59
60
61
62
63
64
65
66