bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Isaiah 58
Isaiah 58
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 57
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 59 →
1
God sey, “Make una shaut well-well! Make una tell Israel wey bi my pipol about dia sins!
2
Dem dey woship mi evriday dey sey, dem won know my ways and obey my laws. Dem sey make I just dey give dem my laws, bikos dem dey happy to woship mi.”
3
Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.
4
Una fasting dey make una wiked and una still dey kworel and fight. Una tink sey dis kind fasting go make mi listin to una prayers?
5
Na di kind fasting wey I choose bi dis? Na only di time wey una dey fast una dey-dey honbol? Na just to skrape di hair for una head rish groun, I wont? Abi, na to just wear sak kon sleep for ashes? Na dis one una dey koll fasting, di day wey God wont?
6
Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.
7
Make una share una food with pipol wey dey hongry kon open una door for poor pipol wey nor get house. Den give klot to pipol wey nor get anytin to wear and help una own rilashons.
8
Den my favor go shine for una body like morning sun and una sore go kwik heal. I go always dey to save una and my present go protet una for evriwhere.’
9
Wen una pray, I go ansa una. Wen una koll mi, I go hear una. If una stop to opress pipol and tok wiked words kon stop wiked tins;
10
if una give food to pipol wey dey hongry kon satisfy doz wey nor get, di darkness wey dey round una, go brite like aftanoon sun.
11
Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.
12
Una pipol go build wetin don skata since, dem go build am put for di old foundashon again. Dem go know una as pipol wey ribuild di wall and house wey dem bin skata.”
13
God sey, “If una keep di Sabat Day holy and una nor run follow wetin una wont dat day; if una value my holy day and honor am and una nor travel, work or tok yeye word for dat day,
14
den una go si di joy wey go follow una as una dey serve mi. I go make dem honor una for di whole world and una go enjoy di land wey I give Jakob wey bi una grand-grand papa.” Na mi wey bi God tok all dis tins.
← Chapter 57
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 59 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52
53
54
55
56
57
58
59
60
61
62
63
64
65
66