bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Isaiah 21
Isaiah 21
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 20
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 22 →
1
Dis message na about Babilon. Just as strong breeze dey blow kom from desert, Na so wahala go kom from one land wey pipol dey fear.
2
I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”
3
So bikos of all dis tins wey I hear, my belle kon dey pain mi and e dey make mi fear. E dey pain mi like woman wey won born.
4
My heart dey shake and I dey fear well-well. Before, I dey like wen evening rish, but naw, I dey fear darkness.
5
Dem don arrange di party tabol; put rug for groun where pipol wey dem invite go sidan put. But as dem dey chop and drink, dem kon hear di kommand, “Una wey bi sojas, make una prepare for war!”
6
Den God tell mi, “Make yu go put pipol make dem dey guide, so dat dem go tell yu evritin wey dem si.
7
Dem must shine dia eye to si wen men wey dey ride horse dey kom two-by-two and doz wey dey on-top donkeys and kamels.”
8
Make di guide shaut, “Oga, I dey guide both for day and nite and na where yu sey make I dey, na der I dey”
9
Si, men wey dey ride horse dey kom. Den di guide sey, “Babilon don fall! All di juju wey dem dey woship, skata for groun!”
10
So my pipol Israel, wey dem mash for groun like flower, na di good news wey I hear from God wey dey lead heaven sojas, I don tell una so.
11
Dis message na about Edom pipol. Somebody koll mi from Edom land sey, “Yu wey dey guide, na wen day go break? Na wetin remain for di nite? Make yu tell mi wen all dis tins go end.”
12
So I ansa, “Morning dey kom, but nite go kom again. So if yu won ask again, wen dat time rish, make yu kom back kon ask.”
13
Dis message na about Arabia pipol. Dedan pipol wey dey stay for karavan for di empty kountry for Arabia.
14
Pipol wey wota dey hongry, make una give dem wota drink. Una wey bi Tema pipol, make una give doz strenjas food chop.
15
Bikos dem dey run from swod, bow and all di bad weapons wey dem take dey fight war, bikos dem nor won die.
16
And dis na wetin God wey get pawa dey tok, “Just one year from naw, all di pawa wey Kedar pipol tink sey dem get, go end.
17
Kedar pipol wey dey fight with bow and arrow, na dem strong pass, but na only few of dem go remain. Mi wey bi Oga God for Israel don tok and na so e must mi.”
← Chapter 20
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 22 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52
53
54
55
56
57
58
59
60
61
62
63
64
65
66