bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Isaiah 33
Isaiah 33
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 32
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 34 →
1
Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die, bikos nobody spoil am. Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die, even doh nobody deceive am. Wen yu don spoil and deceive pipol finish, oda pipol go spoil and deceive yu too.
2
So my God, make Yu sorry for us, bikos na Yu wi put awa hope on. Make Yu dey protet us evriday kon save us from trobol.
3
Wen Yu fight for us, nashons dey run! Wen dem hear yor nois, dem dey run skata.
4
Awa enemies propaty dey skata like plant wey ant chop.
5
God dey great well-well! Yes, E dey stay for heaven. E dey judge Jerusalem pipol well-well.
6
Na-im dey make en pipol strong kon make dem dey save. E dey protet and give dem wisdom and na only doz wey dey fear am, E dey do all dis tins for.
7
Si, pipol wey dey ripresent kountries dey kry and doz wey dem send to go make peace, dey sorry for demsef.
8
Di main road dey empty, bikos nobody dey travel again. Kontries dey break di agriment wey dem make with each oda and pipol nor dey respet one anoda again.
9
Di land don dry and nor-tin dey inside again. Lebanon forest don dry finish; Sharon valley bi like desert naw and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.
10
God tell di nashons sey, “Naw, I go get up! I go show how my pawa big rish kon make una respet mi.
11
Una just dey make yeye plans and evritin wey una dey do, dey yuzles. Di air wey una dey breath, na fire wey go distroy una.
12
Una go skata like rocks wey dem dey burn take make lime; like shuku-shuku wey dey burn to ashes.
13
So make evribody wey dey near and far hear wetin I don do, so dat dem go know how my pawa bi.”
14
Zion pipol wey dey sin, dey fear! Pipol wey nor dey fear God, dey shake. Dem sey, “E get any one of us wey fit survive dat kind fire?”
15
Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite; wey nor dey shit poor pipol, bikos e get pawa and wey nor dey take bribe, join doz wey kill pipol or join do bad tins,
16
na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well. E go get food and wota to chop and drink.
17
E nor go tey again before una go si one good king wey dey rule well with one kingdom wey big and wide well-well.
18
Una go remember all di wahala wey una face before, den una go ask unasef, “Where dem rite dis tins put? Where di pesin wey dey hold di money? Where di pesin wey dey kount di towa?”
19
Una nor go ever si sturbon pipol wey go dey speak language wey una nor undastand again.
20
Instead, una go si Zion, di town where wi for dey celebrate awa festival. Una go si Jerusalem too! E go dey save well-well and pipol go stay der! E go bi like tent wey dem nor dey karry komot from where e dey; tent wey dem nor dey pul en peg from groun and en rope nor go kut.
21
True-true, God go rule for der as awa king. River wota go dey flow pass awa land. No war ship or big ship go drive pass am.
22
Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.
23
For dis time, all awa enemies ship rope don slak; di ship don weak well-well! Wi go seize all di propaty wey awa enemies sojas get kon divide dia propaty among doz wey nor fit waka.
24
Nobody for Zion go sey, “I know well or I dey sick”, di pipol wey dey der, God go forgive dem dia sins.
← Chapter 32
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 34 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52
53
54
55
56
57
58
59
60
61
62
63
64
65
66