bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Isaiah 23
Isaiah 23
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 24 →
1
Dis message na about Tyre pipol. Una wey dey drive ship, make una kry with pain. Dem don skata una house and dem tell una di news as una ship dey kom from Cyprus.
2
Make una kry! Una wey dey stay near river and una wey bi tradas for Sidon, men wey dey travel round sea,
3
go sell food wey dem harvest for Egypt and dey do business with pipol for oda kountry.
4
Sidon pipol, make shame katch una, bikos sea and ocean don rijet una kon dey sey, “Wi neva feel pain like woman wey won born or sey wi don born pikin before; wi neva even train shidren before.”
5
Even Egypt pipol go sopraiz well-well wen dem hear evritin wey happen for Tyre.
6
So, Foenicia pipol wey dey stay near di sea, make una kry well-well! Make una run go Tarshish!
7
Una sure sey dis na Tyre, di town where dem for dey celebrate since? Town wey God kreate, wey en pipol dey difren place for di world?
8
Who bring all dis wahala kom Tyre wey en pipol na prince and wey pipol dey respet dia tradas well-well for di world?
9
Na God wey dey lead heaven sojas do am. E do am to stop dia pride and to ponish dia pipol wey oda pipol dey respet.
10
Una wey dey Tarshish, make una travel go back to una land, just as pesin dey cross River Nile, bikos Tyre don skata.
11
God stresh en hand go di sea kon konker kingdoms, den kommand make dem distroy all di strong town for Kanaan.
12
God sey, “Sidon town, una joy don end and dem go opress una. Even if una run go Cyprus, una nor go dey save for der.”
13
Make una si Kaldean town, pipol wey nor know where dem from kom! Assyria pipol don turn di land to where wild animals dey stay. Dem don skata dia towas, distroy dia strong town kon turn am to where dem dey trow dirty put.
14
So, una wey dey drive big ship, make una kry well-well, bikos dem don distroy di town where una for bin dey save.
15
For dat time, dem go forget Tyre for seventy years, wey bi di normal years wey king suppose stay for dis world. Wen dat time don pass, pipol go know Tyre again and e go bi like di ashawo wey dey dis song:
16
“Make una take di harp kon go round di town, una wey bi ashawo wey dem don forget! Make una play and sing una song, so dat men go kom meet una again.”
17
Wen di seventy years don pass, God go make Tyre strong again. Di town go kon rish and go dey sell tins give all di oda kingdoms.
18
Di profit wey dem go make, dem go gi-am to God. Dem nor go keep di money or allow am many for one place, but dem go give di profit to pipol wey always dey stay God present and dis pipol go use am take buy enough food and fine-fine klot wey dem go wear.
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 24 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52
53
54
55
56
57
58
59
60
61
62
63
64
65
66