bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Isaiah 32
Isaiah 32
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 33 →
1
Di time dey kom wen one king go rule well and di leaders go dey judge well too.
2
Dem go bi like house wey pesin hide put bikos of heavy rain. Dem go bi like wota wey dey rush for desert; like big rock wey en shadow kover empty land.
3
Dia eyes nor go dey blind and dia ears go dey listin well to hear wetin di pipol wont.
4
Dem nor go wiked again and dem go dey do tins and tok to dia pipol well.
5
Nobody go sey foolish pipol get sense and doz wey dey deceive odas, nobody go sey dem wise.
6
Foolish pipol dey tok anyhow and na wikedness full dia mind. Tins wey God nor like, na-im dem dey like to do and dem dey tok yuzles tins about di Oga awa God. Pipol wey dey hongry, dem dey make hongry kill dem more and doz wey nid wota, dem nor dey gri give dem wota drink.
7
Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol, dem dey always dream about, even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.
8
But good pesin dey plan to do good tins and na-im karata dey save am.
9
Wimen wey dey enjoy life, make una listin to wetin I dey tok! Di wimen wey get heart well-well and nor kare about anytin, make una listin to mi:
10
“Una fit dey okay naw, but by dis time next year, una go dey hongry, bikos grapes nor go dey wey una go gada; una nor go even si any fruit chop.
11
Una dey enjoy life since and nor kare about anytin, but naw, make una shake dey fear! Make una pul una klot kon tie rag for una waist.
12
Make una kry, bikos dem don distroy una good land and una vineyards.
13
Make una kry well-well, bikos shuku-shuku and grass don grow kover di land. Make una kry for all di house and towns wey pipol for dey happy before.
14
Bikos dem don run leave dia strong town. Di town wey pipol bin full don turn empty place. Nobody dey stay dia hill and towas again and naw, na der wiked donkey and sheep dey for chop grass.
15
Na so dis tins go bi until God go from heaven kon give us new life, den di desert go turn where fruit dey and di fruit tree go many like sey na forest.
16
Dat time, dem go dey judge and trit evribody well both for di desert and for di town
17
and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.
18
God pipol nor go worry again; peace go dey dia house and dem go dey save.
19
But even if dem distroy di forest kon skata di town,
20
di pipol go still dey happy, bikos wota go dey plenty for dem to plant dia seed and dia animals go dey save, bikos dem go si grass chop.”
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 33 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52
53
54
55
56
57
58
59
60
61
62
63
64
65
66